12
Tanksgivin Song 
 
1 For dat time yu go sey:  
“Oga God, I praiz Yu, bikos Yu bin dey vex for mi,  
but naw, Yu dey konfort mi  
and Yu nor dey vex again.   
2 Si! Na God dey save mi.  
I go trust am and I nor go fear.  
Na God dey give mi pawa and strent  
and na-im dey save mi.   
3 As wota dey make pesin wey dey hongry for wota, happy,  
na so too I go happy wen God save mi.”   
4 For dat time, yu go sey:  
“Make wi tank God! Make wi praiz en name!  
Make wi tell evribody about di tins wey E do!  
Make wi tell dem how God big and strong rish.   
5 Make wi sing give God,  
bikos of di great tins wey E don do  
and make di whole world hear di news.   
6 Make evribody wey dey for Zion shaut and sing!  
Bikos Israel God dey holy and great  
and E dey stay with wi wey bi en pipol.”