16
Moab Nor Get Hope 
 
1 So make yu send lamb as gift from Sela town wey dey di desert,  
go give Jerusalem rulers.   
2 Moab wimen dey wait for Arnon River front;  
dem dey waka up-and-down like birds  
wey dem drive komot from en house.   
3 Dem sey, “Make una help  
and defend us from awa enemies.  
Make una protet us bikos dem dey always attack us.  
Make una nor leave us naw wey wi don run komot from dia hand.   
4 Abeg! Make una allow us stay with una,  
so dat una go protet us from awa enemies!  
Wen doz wey opress us don die and distroshon  
nor dey again and awa enemies don disappear,   
5 den one among David shidren-shidren go bi king  
and e go rule di pipol with en whole heart and love.  
E go dey do wetin dey rite  
and e go make sure sey dem nor opress anybody again.”   
6 Judah pipol sey, “Wi don hear how Moab pipol dey karry body up.  
Wi know sey di pipol sturbon well-well,  
but na empty mout dem just dey make.”   
7 So Moab pipol go kry  
bikos of di wahala wey dem dey face;  
all of dem go kry if dem remember di fine food  
wey dem bin dey chop for Kir-Hareset town,   
8 bikos dem don distroy di farm wey dey near Heshbon  
kon skata di vineyard for Sibmah.  
Yes! Di rulers for di nashons skata di vines go rish Jazer  
kon enter di desert, den cross di sea.   
9 So, I kry for Sibmah vine,  
just as I kry for Jazer.  
I dey kry for Heshbon and Elealeh pipol,  
bikos dem distroy all di food wey dem plant.   
10 Nobody get joy or dey happy and inside di vineyard;  
nobody dey dance or shaut;  
no grape even dey to press to make wine,  
bikos I don end dia shaut for joy.   
11 My heart dey kry for Moab  
and Kir-Hareset pipol.   
12 Moab pipol prayer nor go mean anytin,  
even wen dem klimb di hill go dia juju temple go pray and kry!   
13 Dis na di message wey God bin tok about Moab pipol.  
14 But naw, God sey, “For di next three years, Moab pipol and dia propaty go vanish komot dis eart and na few pipol go survive among all di pipol and dem go dey weak well-well.”