24
God Go Judge Di World 
 
1 Si, awa Oga God dey ready to skata di world  
kon turn am to where dem dey trow dirty put.  
E go shake di world kon skata evribody  
wey dey stay inside.   
2 Evribody go sofa; priests and pipol;  
slaves and dia oga dem;  
pipol wey dey buy and sell;  
pipol wey dey borrow odas money  
and doz wey dey borrow from dem;  
plus rish and poor pipol:  
all of dem go sofa di same tin.   
3 Di world go skata finish and nor-tin go remain.  
God don tok and na so e go bi.   
4 Di eart don dry,  
di whole world dey shake like pesin wey kold dey katch  
and e don dry too;  
pipol wey dey popula for dis world,  
don die go.   
5 Di pipol wey dey dis world,  
don skata am with sin,  
bikos dem nor gri obey God law  
or keep en kovenant wey go last forever.   
6 So, God don curse di world.  
Pipol dey pay for wetin dem do  
and dis na why dem dey die anyhow  
and na only few of dem remain for di world.   
7 Di new grape vine don dry and wine nor dey again.  
All di pipol wey dey happy before, don dey vex naw   
8 and dem nor dey play dia drums,  
harps or sing and happy again.   
9 Dem nor dey sing or drink wine again,  
bikos nobody dey enjoy di taste  
bikos e dey bitter naw.   
10 Di whole town don skata and pipol lock diasef inside dia house,  
so dat dem go dey save.   
11 Dem dey shaut for dia street,  
bikos of wetin happen to dia wine.  
Happiness don komot di land forever  
and na sorrow full der naw.   
12 Di town don skata  
and en gate don fall for groun.   
13 Dis na wetin go happen for evriwhere for di world.  
E go bi like wen dem dey plok olive tree fruit for harvest time  
kon leave only di small-small wons for der.   
14 Di pipol wey go survive  
go sing with happiness;  
doz wey dey for west  
go tok how God big and great rish   
15 and doz wey dey for east,  
go praiz am.  
Di pipol wey dey stay near sea  
go praiz di Oga wey bi Israel pipol God.   
16 Pipol go dey sing for evriwhere for di world as dem  
dey praiz Israel pipol God wey dey raitious.  
But I nor get hope at-all and na die I dey die go so,  
bikos pipol wey dey lie,  
still dey lie and doz wey dey deceive odas,  
still dey deceive!   
17 So make evribody listin to mi!  
Wahala, big pit and trap wey dem set dey wait to katch  
and kill all di pipol for dis eart.   
18 Anybody wey run from di wahala go fall for di pit  
and anybody wey won eskape from di pit,  
di trap go katch am, bikos wahala  
like heavy rain go fall from heaven  
and di eart foundashon go shake.   
19 Di world don break to pieces;  
e don krack open kon dey shake well-well.   
20 Di world go stagga like drunkard man;  
e go shake like house wey heavy rain dey disturb.  
En sin go draw am fall for groun;  
e go fall and e nor go raiz-up again.   
God Go Bi King 
 
21 For dat time, God go ponish di wiked spirits  
wey dey di sky with doz  
wey dey rule as kings for dis world.   
22 God go gada dem put for pit,  
lock dem for prison  
and afta dem don stay der tey,  
E go kon ponish dem.   
23 Di moon go dey dark and sun nor go shine again,  
bikos Oga God wey dey lead heaven sojas,  
go rule from Mount Zion for Jerusalem  
and evribody go si en glory wey big well-well.