29
Jerusalem Faith 
 
1 Jerusalem, David town,  
una own don finish!  
Make una kontinue to dey do una sakrifice evry year,  
just as e suppose bi.   
2 But mi God go bring wahala kom di town;  
dem go mourn and kry  
and e go bi like my altar where dem for dey do sakrifice.   
3 I go bi una enemy and I go attack,  
seize and distroy di town.   
4 Jerusalem go fall and as dem dey groun dem go kry for help,  
but nobody go hear dia vois.   
5 Jerusalem, all di strenjas wey attack yu  
and di sojas wey make yu dey fear,  
na wons God go blow dem komot like ordinary dust.   
6 Den God wey dey lead heaven sojas  
go send en judgement kom with tonda,  
eartkweke and one loud vois.  
E go send strong rain  
and betta fire follow dem too.   
7 E go bi like dream; like vishon for nite.  
Wahala go dey for all di pipol wey dey fight and disturb God town.   
8 E go bi like man wey dey hongry,  
wey dream sey e dey chop, but wen e wake-up,  
e si sey en belle still empty.  
E go bi like man wey dey hongry for wota  
kon dey dream sey e dey drink,  
but wen e wake-up,  
e si sey wota still dey hongry am well-well.  
Na so e go bi for all di pipol wey dey fight  
and disturb Mount Zion.   
Warnin 
 
9 Make una kontinue to dey fool unasef!  
Make una dey bihave like pesin wey nor dey si!  
Make una dey stagga fall even wen una nor drink wine.  
Yes! Make una dey stagga waka,  
even doh una nor drink!   
10 God don make una dey do like sey una don drink,  
so una go sleep go.  
God don blind di profets eyes  
and doz wey dey sey future nor go fit si anytin again.   
11 To una, evritin wey di profet tok, bi like word wey dem rite for book kon klose am. Wen dem gi-am to pesin wey sabi read kon sey, “Read am,” e go ansa, “I nor fit, bikos dem klose am.”  
12 Or if una gi-am to pesin wey nor sabi read make e read am, e nor go fit, bikos e nor sabi read.   
13 God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi,  
dem dey tok good-good tins about mi,  
but dem nor really dey respet mi  
and evritin wey dem tok nor rish dia heart.  
Dia relijon na law and tradishon  
wey human being make with dia own hand.   
14 So I go still do tins wey go dey sopraiz dem:  
tins wey dem nor go undastand.  
Wise men nor go get anytin to tok;  
doz wey get sense nor go fit esplain wetin dey happen.”   
15 Pipol wey dey try to hide dia plans from God,  
nor betta pass doz wey don die!  
Dem dey hide do dia work for korna,  
dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do,  
bikos dem dey boast sey,  
“Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”   
16 Dem dey turn evritin up-side-down.  
Wish one dey important pass:  
di pesin wey dey mold di klay or di klay?  
Wetin pesin make fit ask am,  
“Na yu make mi?”  
Abi di pot fit tell who dey make am sey,  
“Yu know wetin yu dey do so?”   
Hope Wey Dey Di Future 
 
17 So e nor go tey again before Lebanon forest go turn betta groun  
and di betta groun so for Lebanon,  
go produce good good food.   
18 Wen dat day rish,  
deaf pipol go hear words wey dem read from book give dem  
and blind pipol go si even inside darkness.   
19 Poor pipol and doz wey honbol diasef  
go si di happiness wey di Oga wey bi Israel pipol God, dey give.   
20 Bikos pipol wey dey opress odas go vanish  
and all doz wey like to dey do bad tins, go die.   
21 God go distroy doz wey dey lie against dia neighbours;  
pipol wey dey katch and kill pipol  
and doz wey nor dey give korrect judgement.   
22 So Oga God wey diliver Abraham,  
dis na wetin E dey tell Jakob shidren-shidren:  
“My pipol, dem nor go disgrace una again  
and una nor go dey shame again.   
23 Wen una go si di shidren wey I go give una,  
den una go know sey na mi bi Israel God wey dey holy  
and una go honor my name.  
Una go honor mi wey bi una King.  
Yes! Una go respet Israel pipol God.   
24 Doz wey dey foolish go undastand well  
and pipol wey dey always komplain, go get wisdom.”