32
Betta Judgement And Wisdom 
 
1 Di time dey kom wen one king go rule well  
and di leaders go dey judge well too.   
2 Dem go bi like house wey pesin hide put  
bikos of heavy rain.  
Dem go bi like wota wey dey rush for desert;  
like big rock wey en shadow kover empty land.   
3 Dia eyes nor go dey blind  
and dia ears go dey listin well to hear wetin di pipol wont.   
4 Dem nor go wiked again and dem go dey do tins  
and tok to dia pipol well.   
5 Nobody go sey foolish pipol get sense and doz wey dey deceive odas,  
nobody go sey dem wise.   
6 Foolish pipol dey tok anyhow  
and na wikedness full dia mind.  
Tins wey God nor like, na-im dem dey like to do  
and dem dey tok yuzles tins about di Oga awa God.  
Pipol wey dey hongry, dem dey make hongry kill dem more  
and doz wey nid wota, dem nor dey gri give dem wota drink.   
7 Na so-so wiked tins pipol wey dey deceive odas dey tink  
and na di wiked tins wey dem won do to poor pipol,  
dem dey always dream about,  
even wen di poor pipol dey do wetin dey rite.   
8 But good pesin dey plan to do good tins  
and na-im karata dey save am.   
Judgement And Restorashon 
 
9 Wimen wey dey enjoy life,  
make una listin to wetin I dey tok!  
Di wimen wey get heart well-well  
and nor kare about anytin, make una listin to mi:   
10 “Una fit dey okay naw,  
but by dis time next year, una go dey hongry,  
bikos grapes nor go dey wey una go gada;  
una nor go even si any fruit chop.   
11 Una dey enjoy life since and nor kare about anytin,  
but naw, make una shake dey fear!  
Make una pul una klot kon tie rag for una waist.   
12 Make una kry, bikos dem don distroy  
una good land and una vineyards.   
13 Make una kry well-well,  
bikos shuku-shuku and grass don grow kover di land.  
Make una kry for all di house  
and towns wey pipol for dey happy before.   
14 Bikos dem don run leave dia strong town.  
Di town wey pipol bin full don turn empty place.  
Nobody dey stay dia hill and towas again and naw,  
na der wiked donkey and sheep dey for chop grass.   
15 Na so dis tins go bi until God go from heaven  
kon give us new life,  
den di desert go turn where fruit dey  
and di fruit tree go many like sey na forest.   
16 Dat time, dem go dey judge and trit evribody well  
both for di desert and for di town   
17 and bikos evribody dey do wetin dey rite,  
peace and sekurity go dey der forever.   
18 God pipol nor go worry again;  
peace go dey dia house and dem go dey save.   
19 But even if dem distroy di forest  
kon skata di town,   
20 di pipol go still dey happy,  
bikos wota go dey plenty for dem to plant dia seed  
and dia animals go dey save,  
bikos dem go si grass chop.”