55
God Mesi 
 
1 God sey, “All of una wey wota dey hongry,  
make una kom drink from dis wota!  
Una wey nor get money,  
make una kom chop!  
Make una kom drink wine and milk  
and una nor go pay anytin!   
2 Why una dey spend una money for wetin  
nor go beleful una?  
Why una dey spend una money  
wen una know sey hongry go still kill una?  
Make una listin and do wetin I tok,  
den una go enjoy di best food.   
3 My pipol, make una open una ear  
as una dey kom meet mi;  
make una kom meet mi and una go get life!  
I go give una kovenant wey go last forever  
kon give una di blessings wey I promise David.   
4 I make am leader and kommander for many nashons  
and I show dem my pawa thru am.   
5 Naw, una go gada oda nashons wey una  
nor know before.  
And nashons wey nor know una before,  
go run kom meet una!  
Bikos mi wey bi di Oga una God,  
di Pesin wey bi Israel God wey dey holy,  
go make all dis tins happen.  
I go give una honor and glory.”   
6 Make una turn and pray to God  
naw wen E dey near una.   
7 Make wiked pipol turn from dia wiked life  
kon shange di way dem dey tink.  
Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God,  
bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.   
8 God sey, “I nor dey tink as una dey tink  
and una ways difren from my own.   
9 As heaven high pass di eart,  
na so my ways and di way I dey tink,  
high pass una own.   
10 My words bi like snow and rain  
wey dey kom wota di eart from di sky.  
Dem dey make plant grow and provide seed  
wey dem go chop and plant.   
11 Na so e bi too with di word wey I dey tok;  
e go must do wetin I plan for am.  
E go must do evritin wey I send am make e kom do.   
12 Una go komot from Babilon with joy  
and dem go lead una komot from di town with peace.  
Di mountins and hills go dey sing  
and di trees go dey shaut with happiness.   
13 Cypress trees go grow for where grass dey naw.  
Myrtle trees go grow for where shuku-shuku dey.  
Dis sign go dey forever and e go dey remind una  
about wetin mi wey bi God don do.”