58
Betta Fasting 
 
1 God sey, “Make una shaut well-well!  
Make una tell Israel wey bi my pipol about dia sins!   
2 Dem dey woship mi evriday dey sey,  
dem won know my ways and obey my laws.  
Dem sey make I just dey give dem my laws,  
bikos dem dey happy to woship mi.”   
3 Di pipol ask, “Wetin make us dey fast  
and honbol awasef if God nor go ansa us?”  
God kon tell dem, “Di true bi sey, for di time wey una dey fast,  
una still dey opress una workers and run follow tins wey una like.   
4 Una fasting dey make una wiked  
and una still dey kworel and fight.  
Una tink sey dis kind fasting go  
make mi listin to una prayers?   
5 Na di kind fasting wey I choose bi dis?  
Na only di time wey una dey fast una dey-dey honbol?  
Na just to skrape di hair for una head rish groun,  
I wont?  
Abi, na to just wear sak kon sleep for ashes?  
Na dis one una dey koll fasting,  
di day wey God wont?   
6 Nor bi dis kind fasting I choose;  
but wetin I wont bi sey:  
‘Make una remove sin from una body kon give betta judgement,  
den free pipol wey una dey opress.   
7 Make una share una food with pipol wey dey hongry  
kon open una door for poor pipol wey nor get house.  
Den give klot to pipol wey nor get anytin to wear  
and help una own rilashons.   
8 Den my favor go shine for una body like morning sun  
and una sore go kwik heal.  
I go always dey to save una  
and my present go protet una for evriwhere.’   
9 Wen una pray, I go ansa una.  
Wen una koll mi, I go hear una.  
If una stop to opress pipol and tok wiked words  
kon stop wiked tins;   
10 if una give food to pipol wey dey hongry  
kon satisfy doz wey nor get,  
di darkness wey dey round una,  
go brite like aftanoon sun.   
11 Den I go always guide and satisfy una with good tins.  
I go make una dey strong and well.  
Una go bi like gardin wey get plenty wota  
and like wota wey nor go ever dry.   
12 Una pipol go build wetin don skata since,  
dem go build am put for di old foundashon again.  
Dem go know una as pipol wey ribuild di wall  
and house wey dem bin skata.”   
Sabat Day 
 
13 God sey, “If una keep di Sabat Day holy  
and una nor run follow wetin una wont dat day;  
if una value my holy day and honor am and una nor travel,  
work or tok yeye word for dat day,   
14 den una go si di joy wey go follow una as una dey serve mi.  
I go make dem honor una for di whole world  
and una go enjoy di land wey I give Jakob  
wey bi una grand-grand papa.”   
Na mi wey bi God tok all dis tins.