12
Woman Wey Just Born
1 God tell Moses:
2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen woman born and di pikin na boy, e go dey unklean for seven days, bikos di mama nor dey klean wen e dey mestrate.
3 For di eight day, dem go sekonsaiz di pikin.
4 Bikos of di blood wey e lost, di woman go stay for thirty-three days, before e go dey klean. E must nor tosh anytin wey dey holy and e nor go enter di Tabanako, until di day wey dem go santify am, don komplete.
5 If e born girl, e go dey unklean for fourteen days as e bi wen e dey mestrate and e go stay for sixty-six days, before e go dey klean.
6 “ ‘Wen dem don santify am finish, weda na boy or girl e born, e go-go di tent wey dem for dey meet go give di priest one lamb wey bi one year for burnt ofrin and one pijin or dove for sin ofrin.
7 Di priest go give God di ofrin kon do di sakrifice, so dat e go dey holy. Dis na wetin di woman go do afta e don born.
8 “ ‘If di woman nor fit buy di lamb, e fit bring two dove or two pijin, one for burnt ofrin and di oda one for sin ofrin and di priest go do di sakrifice, so dat e go dey holy.’ ”