Exodus
Introdushon
Exodus, Levitikus and Nombas (wey follow Jenesis) na books wey tok about how God start Israel nashon as part of en special plans for di whole world. Wen Israel pipol bi slave for Egypt, God kon show en strong pawa to Fero for Egypt, thru Moses, as God won diliver dem komot from Egypt. For Mount Sinai, God give di Ten Kommandments to Moses. Israel pipol build di Tabanako, so dat God go stay with dem. Den di pipol kon travel for di wildaness go rish Kanaan pipol land. Di main part for di book diskribe all di place wey Israel pipol stay wen dem dey travel inside di wildaness. Di main place dem rish na Mount Sinai and for der, God give Moses en laws for di pipol.
1
God Bless Israel Pipol For Egypt
Dis na Jakob shidren wey follow am go Egypt and each one karry en family follow body: Reuben, Simeon, Levi, Judah, Issakar, Zebulun, Benjamin, Dan, Naftali Gad and Asher. Jakob family for Egypt, na seventy (Josef don already dey Egypt before dem kom).
Afta sometaim, Josef, en brodas and doz wey bi dia age mate kon die. So Israel pipol kon plenty and dey strong for di land. Den one new king wey nor know Josef kon dey rule Egypt. So di king kon tell en pipol, “Make una si, Israel pipol dey plenty and dem strong pass us! 10 Make wi handle dem with sense, if not, dem go dey plenty more-more and if war happen naw, dem go join awa enemies fight us, den dem go run komot from dis land.”
11 So dem kon dey sofa and ponish Israel pipol. Na Israel pipol build Pitom and Rameses as di place wey Fero go dey keep tins put. 12 But even as Egypt pipol dey opress Israel pipol, dem still dey plenty more-more for di land and Egypt pipol kon dey fear dem well-well, 13 so dem kon dey ponish Israel pipol anyhow. 14 Egypt pipol make life taya Israel pipol with di kind hard work wey dem dey do with mortar, stones and all di work for di field.
15 Di king wey dey rule Egypt kon tell Shifrah and Puah wey bi di Hibru nurse sey; 16 “Anytime wen una dey help di Hibru wimen wey won born, if una si sey di pikin na boy, make una kill-am, but if na girl, make una nor kill-am.” 17 But di nurse dem dey fear God and dem nor gri do wetin di king tell dem, so dem nor kill di boys.
18 Den di king koll di nurse kon ask, “Why una do dis kind tin? Why una nor kill di boys?”
19 Di nurse ansa Fero, “Hibru wimen nor bi like Egypt wimen; dem strong well-well and before wi go even rish der, dem don born!”
20 So God favor di nurse dem and Israel pipol kon dey plenty and strong. 21 Bikos di nurse dem dey fear God, Oga God kon give dem dia own family.
22 So Fero kommand en pipol, “Make una go kill any boy wey dem just born kon trow dem inside River Nile, but make una leave all di girls.”