13
Uzza Die
1 King David koll and tok to di ofisas with 2 Israel pipol sey, “If una and di Oga awa God go like am, den e betta make wi send message go meet awa remainin brodas, priests and Levi pipol for dia towns sey make dem gada kom 3 follow us go karry God Kovenant Box, wey dem abandon thru-out di time wey Saul bi king.” 4 Wetin David tok, kon make di pipol dey happy.
5 So David gada Israel pipol from Shihor River for Egypt go rish Hamat, so dat dem go-go bring God Kovenant Box from Kiriat-Jearim. 6 David and all di pipol kon go Baalah town (wey bi Kiriat-Jearim), for Judah go bring God Kovenant Box wey dey on-top di creature wey get feada. Na God name dem dey koll di box.
7 Dem bring di Kovenant box kom out from Abinadab house, put am for one new truck and na Uzza and Ahio dey guide am. 8 David with all di pipol kon dey dance with dia heart to honor God. Dem sing dey play instrument, harp, drums, cymbals and trumpets.
9 Wen dem rish where dem for dey separate wheat for Kidon, di truck wey dem put di Kovenant Box kon dey shake like sey e won fall, so Uzza kon hold di box make e for nor fall. 10 At wons, God vex kon kill Uzza, bikos e tosh di box.
11 David vex well-well, bikos God kill Uzza, so e koll di place Perez Uzza and na-im dem dey koll am till today.
12 Den David kon dey fear God dat day so e kon sey, “How I go take karry di Kovenant Box naw?” 13 So David nor karry am go Jerusalem again, instead, e karry am go Obed-Edom wey kom from Gat, house. 14 God Kovenant Box dey Obed-Edom house for three monts, so God bless Obed-Edom family and evritin wey dem get.