John
First Leta
Introdushon
Apostle John, wey bi one for Jesus Christ disciple and wey rite John gospel, rite three letas to difren pipol. E rite di first one to bilivers for evriwhere wey dey esperience difren kinds of wahala. Some of dem don abandon dia faith in Jesus and kon dey follow bad tishings wey deny sey na Jesus Christ bi di Messiah (4:2-3). Di false tishas kon dey tish sey Jesus Christ neva kom for dis world as humanbin, so di bilive sey Jesus Christ na God pikin wey get pawa to save humanbin from sin, nor bi true. John kon warn dem about dis false tishing and enkourage dem to live in love as pipol wey know Christ.
1
Di tin wey dey from di biginnin, wey wi don hear and si with awa eye; wey awa hand don tosh (tins wey koncern di word wey dey give life and dis life kom out and wi don si am. Na dis tins wi dey tok about. Wi dey tell una about di life wey nor dey end, wey dey with di Papa for heaven and E don show am to us. Na wetin wi don si and hear, wi dey tell una, so dat una go fit bi awa friend, just as wi bi friend with di Papa and en Pikin.) Na dis make us dey rite dis leta, so dat awa joy go full well-well.
Waka For Lite
Na di message wey wi hear from am, naim wi dey tell una so: Na God bi lite and darkness nor dey inside am at-all. If wi sey wi bi en friend and wi still dey inside darkness, wi dey lie and trut nor dey awa mout. But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot. If wi sey wi nor get sin, wi dey deceive awasef and di trut nor dey inside us. But if wi konfess awa sin to am, e go forgive us kon wosh evritin wey nor good for God eye komot from awa life, bikos Christ dey always do wetin e sey e go do, since e dey raitious. 10 If wi sey wi nor dey sin, dat mean sey, God dey lie and di trut nor dey inside us.