5
Pipol Wey Love God
Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born. Wi go know sey wi love God shidren, wen wi love God and obey en kommandment. To love God, na to keep en kommandment and en kommandment nor dey hard. Anybody wey bi God pikin, don win di world and na awa faith bi di pawa wey win di world.
Pesin wey bilive sey Jesus Christ na God Pikin, don win di world. Na Jesus Christ kom dis world with wota and blood. Nor bi only with wota, but na with di wota and di blood. And God Spirit bear witness sey dis na true, bikos na God Spirit bi di trut. Wi get three witness to show sey wetin wi dey tok, na true and dem bi: God Spirit, di wota and di blood and dis three witness dey tok di same tin.
If wi gri sey wetin human being tok na true, den wetin God tok about en pikin, naim big pass. 10 (Di pesin wey bilive God Pikin, go know inside ensef sey, dis tin na true, but pesin wey nor bilive God, dey sey God dey lie, bikos e nor bilive wetin God tok about en Pikin). 11 Dis na wetin God tok: God don give us life wey nor dey end and dis life dey inside en Pikin. 12 Anybody wey get di Pikin, get di life wey nor go end, but doz wey nor know God Pikin, go die.
13 I don rite all dis tins give una wey bilive God Pikin, so dat una go know sey una get life wey nor go end.
14 Na dis tins dey make awa mind strong anytime wey wi kom meet God: bikos if wi ask am for anytin wey dey good for en eye, E go give us. 15 And if wi know sey E dey hear us, den wi bilive sey wi go get di tins wey wi ask from am. 16 If anybody si en broda or sista for Christ dey kommit sin wey nor go kill-am, make e ask God and God go give life to dat pesin. E get di kind sin wey dey kause deat and I nor sey make una pray make God forgive di pesin wey dey kommit dat kind sin. 17 Evritin wey nor good for God eye, na sin, but e get di sins wey nor dey kause deat.
18 Wi know sey anybody wey bi God pikin, nor dey like to sin, but God dey keep en pikin, so dat devil nor go fit tosh am. 19 Wi know sey wi bi God shidren and dis world wey wi dey so, na wiked pipol dey rule am. 20 Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end. 21 So my shidren, make una make sure sey una nor get anytin to do with oda gods.