First Kings
1
Wen David Don Old
Naw, David don old well-well and even wen dem kover am with klot, kold go still dey katch am. So en ofisas tell am, “My king, make wi find one yong woman wey neva sleep with man before. E go dey sleep near yu and yor body go dey warm.”
Dem find evriwhere for Israel and dem si one fine girl kon karry am go meet di king, Di girl kom from Shunem and en name na Abishag. Di girl fine well-well, e dey kare and serve di king, but David nor sleep with am.
Adonijah
For dat time, Adonijah wey Haggit born for David kon dey boast dey sey, “Na mi go bi king!” So e buy plenty horse with pipol wey go dey drive dem and with fifty men wey dey escort am. (David neva even ask or korrect am wons sey, “Wetin make yu dey bihave like dis?” Adonijah na very fine man too and naim dem born follow Absalom.)
E follow Joab wey Zeruaya bi en mama and Abiatar wey bi di priest plan and dem kon gri to support am. But Zadok wey bi priest, Benaya wey bi Jehoiada pikin, Natan di profet, Shimei, Rei and David bodyguard, nor gri support am.
One day wey Adonijah go sakrifice sheep and fat melu to God on-top di Snake Stone (Zohelet Stone) near En-Rogel wotaside, e invite di oda shidren wey David born and di ofisas wey kom from Judah make dem kom di sakrifice, 10 but e nor invite Solomon wey bi en half broda, Natan di profet or Benaya and di king bodyguards.
David Make Solomon King
11 Den Natan go meet Batsheba wey bi Solomon mama kon ask, “Yu neva hear sey Haggit pikin, Adonijah, don make ensef king? And David nor know anytin about am! 12 If yu won save yor life and Solomon own, I go advise yu sey, 13 make yu go meet David kon ask am, ‘My king, yu nor promise mi sey, Solomon my pikin go bi king? How kom Adonijah kon bi king naw?’ ” 14 Natan still sey, “As yu still dey tok to di king, I go kom inside kon tell am sey na true yu dey tok.”
15 So Batsheba go meet David for en room, e don old well-well and di girl Abishag wey kom from Shunem dey kare for am. 16 Batsheba bow for di king front and di king kon ask am, “Wetin yu wont?”
17 E ansa, “My king, yu use di Oga yor God name take promise mi sey ‘Yor pikin, Solomon go bi king afta mi and e go sidan for my throne.’ 18 But Adonijah don make ensef king and yu nor know anytin about am. 19 E don use many goat, sheep and fat melu take do sakrifice and e invite Abiatar di priest, yor shidren and Joab wey dey kommand yor sojas, but e nor invite Solomon. 20 My king, Israel pipol dey wait make yu tell dem who go bi king afta yu. 21 If yu nor tok, as yu just die, dem go trit mi and my pikin Solomon, like bad pipol.”
22 As Solomon mama still dey tok to di king, Natan kon kom di house. 23 Dem tell di king sey, “Natan wey bi profet dey der.” Natan enter di room kon bow for di king front.
24 Natan sey, “My king, yu don announce sey na Adonijah go bi king afta yu? 25 Bikos, today, e don use many sheep, goat and fat melu take do sakrifice. E invite all yor shidren, Joab wey dey kommand yor sojas and Priest Abiatar and as wi dey tok so, dem dey do party dey shaut sey, ‘Adonijah, yu bi king! Make yu live forever!’ 26 But e nor invite mi, Priest Zadok, Benaya and yor savant Solomon. 27 My oga know all dis tins and yu nor even tell yor ofisas who go bi king afta yu?”
28 David ansa, “Make yu tell Batsheba make e kom inside,” so di woman kom kon stand for di king front.
29 Den e tell am, “God wey save mi from all my trobols, I use en name take promise yu 30 sey, I go keep di promise wey I make with Israel God name sey, na Solomon go bi king afta mi.”
31 Batsheba bow kon sey, “Make my oga, di king live forever!”
32 Den David sey make dem koll Zadok, Natan and Benaya. Wen dem enter, 33 e tell dem, “Make una take my ofisas follow body; make Solomon my pikin ride my horse, den una escort am go Gihon wotaside, 34 where Natan and Zadok go anoint am as Israel king. Den make una blow di trumpet kon shaut, ‘Solomon, yu bi king! Make yu live forever!’ 35 Make una follow am kom back kon sidan for my throne. E go bi king afta mi, bikos naim I don choose to rule Israel and Judah pipol.”
36 Benaya ansa, “I go do as yu tok and make God wey bi yor God asept am as king! 37 As Oga God don dey with awa king, make E dey with Solomon and make E prosper am, pass yu.”
38 So Zadok di priest, Natan di profet, Benaya and di royal bodyguards kon put Solomon for David horse and dem escort am go Gihon wotaside. 39 Zadok karry di olive oil wey e bring from Tabanako kon use am anoint Solomon. Dem blow di trumpet and all di pipol kon shaut, “Solomon, na yu bi king! Make yu live forever!” 40 Den all of dem follow am go back dey happy, dey shaut, blow flute, dey make plenty nois and di groun kon dey shake.
41 As Adonijah with all di pipol wey e invite dey finish dia party, dem kon hear di nois. Wen Joab hear di trumpet, e ask, “Wetin dey bring dat kind nois for di town?”
42 Before e tok finish, Jonatan wey bi Priest Abiatar pikin kon enter. Adonijah sey, “Make yu kom inside. Yu bi good man, na betta news yu go dey bring so.”
43 Jonatan ansa, “Nor bi as yu wont am, bikos David don make Solomon king. 44 E send Zadok, Natan, Benaya and di palis bodyguard make dem put am for en horse kon escort am, 45 den Zadok and Natan anoint am for Gihon wotaside as king. So pipol enter town bigin shaut dey happy and na dat bi di nois wey yu dey hear so. 46 Na Solomon bi king naw. 47 Di one wey worse pass bi sey, all di ofisas go meet David kon tell am, ‘God go make Solomon dey great pass yu and en reign go pass yor own ten times.’ Den King David bow woship God from en bed 48 kon pray sey, ‘Make wi praiz di Oga wey bi Israel pipol God, wey don make one of my pikin take my place as king and E make mi dey alive to si am!’ ”
49 Den doz wey Adonijah invite kon dey fear and all of dem stand up bigin go one-by-one. 50 Adonijah kon dey fear Solomon so e go di tent for God present kon hold di horn wey dey di altar. 51 Dem tell Solomon sey, bikos Adonijah dey fear am, e go hold di horn wey dey di altar kon sey, “I wont make Solomon swear for evribody present sey e nor go kill mi.”
52 Solomon ansa, “If e go respet mi, I nor go even tosh one hair for en head, but if e nor respet mi, I go kill-am.” 53 Solomon send dem go koll Adonijah from di altar. Adonijah go meet am kon bow for en front, so di king kon tell am sey make e dey go en house.