26
David Sorry For Saul Again
1 Zif pipol kom meet Saul for Gibeah sey, “David hide for Hakilah hill wey dey near Jeshimon.”
2 So Saul take 3,000 strong sojas wey e selet from Israel kon go find David for Zif desert. 3 Saul kamp for di road wey dey near Hakilah hill near Jeshimon, but David dey inside di desert. Wen David know sey Saul dey di desert dey find am, 4 e kon send pipol go spy if na true.
5 So David kon go di place where Saul kamp put. E si where Saul, Ner pikin Abner and en sojas sleep put. Saul sleep inside di kamp, while en sojas kon sleep round am.
6 David tell Ahimelek wey kom from Hit and Abishai; Joab broda wey kom from Zeruaya sey, “Who go follow mi go meet Saul for en kamp?”
Abishai kon ansa, “I go follow yu go.”
7 So David and Abishai kon rish der dat nite and dem si sey Saul dey sleep inside di kamp and e pin en spear for groun near en head. Abner and di sojas sleep around am.
8 Abishai kon tell David, “Today, God don put yor enemy for yor hand. So make yu let mi shuk en head join groun. I nor nid to do am two times!”
9 But David ansa, “Nor kill-am! Na who go happy sey e kill di pesin wey God ensef choose?” 10 David still sey, “As God dey alive, na God go kill-am by ensef. One day e go sleep nor wake-up or dem go kill-am for war. 11 God forbid sey I kill di pesin wey E choose with en hand.” David kon tell Abishai, “Take en spear and en wota pot make wi komot from here!”
12 So David take di spear and di wota pot wey dey near Saul head and dem kon komot der. Nobody si dem or know sey dem kom or wake-up. All of dem don sleep go, bikos God don make betta sleep katch dem.
13 Den David cross go di oda side kon stand for far on-top di hill and betta gap dey between en and Saul. 14 E shaut give Abner wey bi Ner pikin, “Abner! Yu nor won ansa?”
Abner kon ansa, “Who bi yu wey dey shaut won wake di king?”
15 David kon tell Abner, “I tink sey yu bi man? Afta all, who rish yu for di whole Israel land? Wetin kon make yu nor fit guide yor king? One soja almost won kill yor oga di king. 16 Yu don fail for yor work. As long as God dey alive, una wey nor fit protet una oga wey God choose as king, dead body betta pass una. Naw make yu find di king spear and wota pot wey dey near en head!”
17 Wen Saul know sey na David, e kon sey, “David my pikin, na yor vois bi dat?”
David ansa, “Yes! My oga di king, na my vois.” 18 David still sey, “Wetin make my oga di king dey porshu en savant? Wetin I do? Wish bad tin I do? 19 So naw, make my oga di king listin to wetin en savant won tok. If na God make yu hate mi; if I offa ofrin to am, E go shange en mind, but if na human being make yu hate mi like dis, God curse go fall for dia head! Bikos dem don porshu mi komot from God land wen dem sey, ‘Make yu go. Go serve anoda god!’ 20 Naw my king, nor let dem kill mi for land wey nor bi God own, bikos sey yu dey look for ant like mi, just as pesin dey look for animal for bush.”
21 Saul kon ansa, “David my pikin, I don sin! Make yu kom back. I nor go kill yu, bikos yu don save mi today. I bi like fool today and I don make big mistake.”
22 David ansa, “Di king spear dey here.” Make one of di savant cross kom take am. 23 “God dey reward doz wey dey honest and raitious. Even doh today God put yu for my hand, I nor go ever kill di pesin wey God use en own hand choose. 24 Just as I save yor life today, make God save mi from evry trobol and wahala!”
25 So Saul ansa David, “My pikin! Make God bless yu. Yu go dey prosper for evritin wey yu do.”
So David go en own way and Saul kon go back.