9
God Judgement
I si God stand near di altar kon sey: “Make yu nak di temple pilas for up, until di foundashon go shake.
“Break dem make e fall for di pipol head.
I go kill di remainin pipol for war
and nobody go fit eskape.
Even if dem dig and hide for inside grave,
I go still katch dem.
And if dem klimb go heaven,
I go bring dem kom down.
If dem hide on-top Mount Karmel,
I go find and katch dem.
If dem hide for bottom sea,
I go kommand di wiked animals for sea
make e bite dem die.
If dia enemies karry dem go as slave,
I go orda make dem kill dem.
I don ready to distroy dem and nor bi to help dem.”
Oga God wey get pawa, tosh di eart and e shake;
evribody wey dey stay der dey mourn
and di whole world dey raiz and fall like Nile River.
God build en house for di heavens
and put di foundashon for dis eart.
E draw di wota wey dey di sea
kon pour am for di eart.
En name na God!
God sey,
“Israel pipol, una dey important to mi
pass Ethiopia pipol?
Just as I bring Filistia pipol kom out from Krete
and Siria pipol kom from Kir,
na so too, I bring una kom out from Egypt.
Mi wey bi God wey get pawa
dey look as Israel kingdom dey sin,
so I go distroy dem komot for dis eart.
But I nor go distroy Jakob shidren-shidren finish.
I go kommand make dem shake Israel pipol
just as dem dey shake korn wey dey tray.
I go shake dem with di oda kountries,
so dat di yuzles ones among dem go fall komot.
10 Doz wey dey sin among my pipol,
dem go kill dem for war;
pipol wey bin sey,
‘God nor go allow anytin bad happen to us.’ ”
Israel Future
11 God sey,
“For dat day, I go ribuild David kingdom wey fall.
I go ripair en fence kon build am back.
I go build am again kon make am bi as e bi before.
12 Den Israel pipol go take all wetin remain for Edom land
and all di nashons wey bi my own.”
God don tok and na so e go happen.
13 God sey,
“Di day dey kom wen korn go kwik grow
even before harvest time rish
and grape go grow kon ripe
before dem suppose make wine.
Sweet wine go dey rush kom out from di mountins
and wine go dey flow for di hills.
14 I go bring my pipol kom back to dia land.
Dem go ribuild dia towns wey skata
kon stay der again;
dem go plant vine kon drink di wine;
dem go plant food for dia farm kon chop
wetin dem plant.
15 I go plant my pipol for di land wey I give dem
and nobody go fit rut dem komot again.”
Na so Oga God tok.