Paul Leta To
Galatian
Bilivers
Introdushon
Na Paul first prish for Galatia, so di Christians for di church for der, kon bi like en own shidren. But afta Paul leave dem, some pipol kon kom to tell di Christians sey wetin Paul tish nor bi di true gospel. Dis pipol kon mislead di Galatian bilivers dey sey, unless dem sekonsaiz, dem nor di true Christian (1:6-7). Dem also sey Paul nor bi true apostle bikos e dey tish pipol wetin nor korrect (2:1-10). Na dis tins make Paul rite dis leta to dem. E tell dem sey dem nor nid to sekonsaiz for dem to bi Christian. Di big message bi sey na only faith in Christ dey save pesin, not to just obey di law (3:26-27), bikos di law nor get pawa to do am. So Gentile pipol wey dey follow Jesus, nor nid to sekonsaiz at-all, for dem to bi Christian.
1
I Salot
Na mi Paul, rite dis leta, (nor bi human being make mi apostle, but na Jesus Christ and God awa Papa wey raiz am from deat). Mi and di brodas wey dey here, dey greet una wey dey Galatia. Make God awa Papa and Oga God Jesus Christ grace and peace, dey with una. Na Jesus die for awa sins, bikos na so God awa Papa wont am. Make all glory bi en own forever and ever! Amen.
One Gospel
I sopraiz sey una kwik turn back from di Pesin wey koll una with en grace kon bigin follow oda tishing. Nor bi sey anoda gospel really dey, but some pipol dey disturb una, bikos dem won shange wetin wi prish about Christ. But if wi (or angels wey kom from heaven) tish una difren tins from di one wey wi prish give una before, make God distroy us with fire! As I tok before, I dey repeat am again, if anybody dey tish difren tins from di ones wey wi prish give una before, make God trow dat pesin for hell! 10 Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!
Paul Na Apostle
11 My brodas and sistas, I wont make una know sey di gospel wey I dey prish, nor bi human being give mi. 12 Bikos I nor get or learn am from anybody, but I get am thru di revelashon wey Christ give mi.
13 Una don hear about di kind life wey I dey live before as Jew pesin; how I trobol di church kon dey try to distroy am. 14 I grow among Jew pipol kon know di relijon pass many of my mates for my kountry and I know my grand-grand papa dem tradishons. 15 But God koll mi with en grace kon separate mi even before dem born mi. 16 E show mi en pikin, so dat I go fit prish about am give Gentile pipol. I nor go meet anybody make e advise mi 17 and I nor go Jerusalem go meet pipol wey bi apostle before mi, but I komot der go Arabia, den I kon go back to Damaskus.
18 Afta three years, I go visit Pita for Jerusalem, so dat e go tell mi wetin I go do and I stay with am for fifteen days. 19 But I nor go si any oda apostle apart from James, wey bi Jesus Christ broda. 20 God dey si wetin I dey rite, bikos evritin wey I dey rite to una so, na true! 21 Afta dis, I kon go Siria and Silisia aria. 22 But di pipol for di church wey dey Judea, nor know mi. 23 Dem only dey hear sey, “Di pesin wey dey trobol us before, don dey prish di message wey e bin dey try to distroy.” 24 So dem kon dey praiz God bikos of mi.