Jenesis
Introdushon
Jenesis and di oda books wey Moses write (Exodus, Levitikus, Nombas and Deutronomi) na to tell us about Israel pipol story and na dem bi di first part for di Bible. Na Moses take Israel pipol komot from Egypt. Jenesis tok about how Israel take get betta pozishon for God eye, as E dey plan for evry human being. Wen God kreate di world, E get betta plan for us, but awa pride and sin kon spoil evritin. Bikos of di sin, wahala, trobol and sofa wey dey di world, God kon distroy di world with wota. Leta, God kon choose Abraham and promise en and en shidren. Na dis bi di main story for dis book. Israel wey Abraham, bi dia grand-papa, na di pipol wey God choose and na dem E go take bring evribody for di world kom back to ensef. Jenesis end with Israel family wey don kon plenty well-well, but dem nor dey di land wey God promise dem. So di next book (Exodus) kontinue di story. Na twelf sekshon dey di rest of dis book. Each sekshon tok about one main pesin and di life of di pesin. Dem arrange dem like dis, so dat wi go fit undastand human being story from di biginnin.
1
God Kreate Di World
Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart. Di eart nor get shape at-all. E dey empty and darkness kover di wota, but God Spirit dey waka on-top di wota.
So God kon sey, “Make lite kom.” And lite kon kom! God si sey di lite dey good, so E kon separate di lite from di darkness. God koll di lite, “Day” and di darkness, E koll am, “Nite.” And dat evening and morning kon make am di first day.
God sey, “Make di wota divide into two, so dat space go dey di middle.” So God separate di wota wey dey under di space from di wota wey dey on-top di space. And na so e kon bi. God koll di space, “Sky.” And dat evening and morning kon make am di sekond day.
God sey, “Make di wota wey dey under di sky gada for one place and make dry groun kom out.” And na so e kon bi. 10 God kon koll di dry groun, “Land” and di wota wey gada, E koll am, “Sea.” God si sey e dey good. 11 God kon sey, “Make di land produce difren plants: plants wey go bear seeds akordin to how dem bi and trees wey go bear fruit akordin to how dem bi.” And na so e kon bi. 12 Di land produce difren plants; di ones wey dey bear seeds and fruits, akordin to dia kind. God kon si sey e dey good. 13 So dat evening and morning kon make am di third day.
14 God sey, “Make lite dey for di sky wey go separate di day from di nite and make sign dey wey go show sizin, days, years 15 and make dem bi lite for di sky wey go give lite to di eart.” And na so e kon bi. 16 God make two big lite: di one wey big pass go shine for day time and di small one go shine for nite. God make di stars too. 17 God put di lite for di sky, so dat e go dey shine for di eart 18 and dem go dey rule both for day and nite. Dem go separate lite from darkness. So God si sey evritin dey good. 19 And dat evening and morning kon make am di fourt day.
20 Den God kon sey, “Make difren animals wey get life full di wota and make birds full di sky.” 21 God kreate di big-big fish for sea and evry oda tin wey dey stay inside wota and difren-difren birds. God si sey dem dey good. 22 God bless dem kon sey, “Make una stay di wota kon born many shidren and make di birds born many pikin full di sky.” 23 So dat evening and morning kon make am di fift day.
24 Den God sey, “Make di land produce difren animals akordin to dia kind: kattle, tins wey dey creep for groun and wild animals akordin to dia kind.” And na so e kon bi. 25 God make wild animals, kattle and evritin wey dey creep for groun akordin to dia kind. God kon si sey dem dey good.
26 Den God sey, “Make wi kreate human being like Awasef, just as wi bi, so dat dem go bi oga ova di fish dem for sea and di birds for di sky, plus di kattles and ova di whole eart plus evritin wey dey inside.”
27 So God kon kreate human being like ensef;
as God bi, na so E kreate dem;
both man and woman, na-im E kreate.
28 God bless dem kon sey, “Make una born many shidren full di eart and na una go kare for evritin! Na una bi oga ova di birds for di sky, di fish dem for sea and evritin wey God kreate.” 29 Den God sey, “Evry plant wey dey bear seed and tree wey dey bear fruit, I give dem to una as food. 30 Plus all di animals for di eart; birds for di sky and evritin wey dey waka for groun. Evritin wey dey alive and evry green plant, I gi-am to una as food.” And na so e kon bi. 31 So God si evritin wey E kreate and dem good well-well! And dat evening and morning kon make am di sixt day.