James
Leta
Introdushon
James wey bi one of Jesus brodas and wey kon bi leader for di church for Jerusalem naim rite dis leta. Pipol respet am bikos of di advise wey e give and for di wise decishon wey e help di bilivers make wen di church just dey start for Jerusalem (Acts 15:13-21). E rite di leta to enkourage bilivers wey dey suffer for evriwhere. E sey make dem tink of di joy wey go bi dia own, wen dem endure sufferin and dia patient go help dem ovakom temptashon. E sey na di wisdom wey kom from God bi di tin wey go help bilivers do wetin go make dem get real joy for dis life. James sey if pesin sey e get faith, but e nor use am well, di faith nor get pawa to help oda pipol. Good faith na di one wey dey help pipol wey nid help.
1
I Salot
Mi James, wey bi God and Jesus Christ savant, dey greet una wey bi di twelf tribes wey dey for evriwhere for di world.
Joy Inside Temptashon
My brodas and sistas, make una dey happy wen una dey face temptashon, bikos una know sey, if una win di temptashon, una patient go strong. And make una let patient do en work, so dat una go dey pafet and komplete, den una go gain evritin. But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu. Di pesin wey dey ask, must get faith and make en mind nor shake, bikos anybody wey en mind dey shake, bi like river wey strong breeze dey blow up-and-down. Make dat pesin nor tink sey e go receive anytin from God, bikos e get doubol mind and e nor dey stabol for anytin wey e dey do.
Any biliver wey poor, make e happy, bikos God don lift am up. 10 But pesin wey get money, make e nor proud, bikos e go soon perish like flower wey dey for bush. 11 As sun dey dry grass and flower and dia beauti dey die forever, na so rish pesin go dry, as e dey porshu and love money. 12 Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am. 13 Make nobody tok wen temptashon kom meet am sey, “God dey test mi,” bikos nor-tin fit tempt God and God ensef, nor dey tempt anybody. 14 But temptashon dey kom meet pesin wey get bad tins for mind. 15 Wen di bad tins wey e won do, don mature, e go make am sin and wen sin don grow well-well, e go kause deat. 16 My brodas and sistas, make nor-tin deceive una, 17 bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange. 18 As God wont am, E kon born us with di true message, so dat wi go bi first among all wetin E kreate.
Do Wetin Di Message Tok
19 My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex. 20 Human being vexnashon nor dey make pipol live di life wey God wont. 21 So make una remove una hand from evry dirty and wiked tins kon put una body down to asept God word wey dem don plant inside una, bikos e get pawa to save una soul. 22 Make una nor dey deceive unasef as una dey hear God word, but make sure sey una dey do wetin en word tok. 23 Pesin wey hear God word and e nor dey do wetin e tok, bi like pesin wey dey look en face for mirror. 24 Wen di pesin look ensef finish kon komot go out, e go kwik-kwik forget how en face bi. 25 But di pesin wey dey look God pafet law wey dey free pipol; dey do wetin di word tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey do. 26 If anybody tink sey en dey follow wetin wi dey tish and e nor fit kontrol en mout, dat pesin dey deceive ensef and en relijon nor mean anytin. 27 But betta relijon wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa bikos dia husband don die. So, make una keep unasef, so dat dis world nor go stain una.