Judges
Introdushon
Dis book tok about all di trobol wey follow Israel pipol as dem dey break di kovenant anyhow and dis kon make dem dey sofa under oda nashons. So dem kry to God for help and God ansa dem kon raiz judges wey fight and save dem. But e nor dey tey before Israel pipol kon bigin sin again Di Judges dem na men and wimen, some na sojas and odas na ordinary pipol. Jos as Israel bi twelf tribes, na so too di books tell us about twelf judges. But as di pipol choose to go dia own way, wi kon si sey dem don rijet dia true Judge and Ruler. As di leaders and judges dey kom and go, na so too Israel pipol kon dey wont to get dia own king to rule dem.
1
Judah And Simeon Take Di Land
Afta Joshua die, Israel pipol kon ask God, “Na wish tribe go first go attack Kanaan pipol?”
God ansa, “Na Judah tribe, bikos I don give dem viktory ova di land.”
Den Judah men tell dia relashon from Simeon tribe sey, “Make una join us go fight Kanaan pipol wey dey di aria wey God give us. Den wi go follow una go fight and win una own aria too.” So Simeon men follow Judah pipol.
Wen Judah men attack, God make dem win Kanaan and Periz pipol and dem kill 10,000 men wey dey fight war for Bezek town. As dem dey Bezek, dem meet King Adoni-Bezek kon fight am. Dem win Kanaan and Periz pipol. King Adoni-Bezek kon dey run, but Israel pipol porshu and katch am, den dem kut en big finger from en hand and en big toe for en leg komot.
So Adoni-Bezek sey, “I don kut seventy kings hand and leg komot wons and I make dem chop food from under my tabol. But naw, God don pay mi back for wetin I do to dem.” So, dem karry am go Jerusalem and e die for der.
Den Judah men attack and seize Jerusalem; dem kill all di pipol kon burn di town rish groun.
Afta, dem go fight Kanaan pipol wey dey stay for di hill kountry; Negev and for di hill bottom wey dey for di west side. 10 Dem mash against Kanaan pipol for Hebron (wey dem dey koll Kiriat-Arba before), dem stay der kon fight and win Sheshai, Ahiman and Talmai pipol.
11 From der, dem go fight doz wey dey Debir town (wey dem dey koll Kiriat-Sefer before). 12 Den Kaleb sey, “I go give my dota Aksah as wife to anybody wey go attack and seize Kiriat-Sefer.” 13 Kenaz wey bi Kaleb yonga broda, na-im pikin Otniel attack and seize Kiriat-Sefer. So Kaleb pikin, Aksah kon bi Otniel wife.
14 Di day wen Otniel dey marry Aksah, e kon tell di girl sey make e ask en papa for land. So as di girl kom down from en donkey, Kaleb kon ask am, “Na wetin yu wont?”
15 E ansa, “Abeg make yu give mi anoda gift. Yu don already give mi land for Negev, but naw, I wont make yu give mi place where wota dey.” Den Kaleb kon gi-am di spring for up-and-down.
16 Moses fada-in-law shidren-shidren, wey bi Ken pipol, follow Judah pipol komot from Jeriko, di palm trees town, till dem rish di wildaness for Judah. Dem go stay with doz wey dey der, near Arad town for Negev.
17 Afta, Judah pipol join Simeon pipol go fight Kanaan pipol for Zefat and dem skata di town finish. Leta, dem kon koll di town, Hormah. 18 Dem still attack Gaza, Ashkelon and Ekron town and di oda towns wey dey near der.
19 God dey with Judah pipol, so dem take di hill kountry. But dem nor fit drive di pipol wey dey di koast aria komot, bikos di pipol shariot, bi like iron. 20 So dem give Kaleb, Hebron town just as Moses promise. So Kaleb porshu Anak generashon komot der. 21 Benjamin tribe nor fit porshu Jebus pipol komot Jerusalem finish, so till today, Jebus pipol still dey stay for Jerusalem with Benjamin pipol.
22 Josef shidren-shidren, attack Bethel town and God help dem. 23 Dem send men go spy Bethel (wey dem dey koll Luz before). 24 Dem meet one man dey kom out from di town kon ask am, “Make yu show us how to enter dis town and wi nor go kill yu.” 25 So e show dem and dem kill evribody wey dey di town, escept di man and en family. 26 Leta, di man komot from der kon go Hit pipol land and e build en own town wey e koll, Luz for der. Naim dem still dey koll am till today.
27 Manasseh pipol nor fit drive di pipol for Bet-Shean, Taanak, Dor, Ibleam, Megiddo and doz wey dey near der. So doz pipol still dey stay der. 28 Israel pipol kon get pawa well-well and dem force and turn Kanaan pipol to dia slave, but dem nor drive all of dem komot from di land. 29 Efraim tribe nor fit drive Kanaan pipol wey dey Geza, so Kanaan pipol still dey stay der with dem. 30 Zebulun tribe nor fit drive di pipol wey dey Kitron and Nahalol, so Kanaan pipol still dey stay among dem. But dem force and turn Kanaan pipol to dia slave. 31 Asher tribe nor fit drive di pipol wey dey Akko, Sidon, Ahlab, Akzib, Helbah, Afek and Rehob, komot. 32 Instead, Asher pipol dey stay and kontrol Kanaan pipol wey dey di land, bikos dem nor fit porshu dem komot. 33 Na so too, Naftali tribe nor fit drive Bet-Shemesh and Bet-Anat pipol komot, instead, dem dey stay and kontrol Kanaan pipol wey dey di land. Dem force di pipol to work for dem as dia slave. 34 Amor pipol force Dan tribe go stay for di kountries wey dey di hill and dem nor let dem kom down again. 35 Amor pipol still dey stay for Mount Heres, Aijalon and Shaalbim, but wen Josef shidren-shidren don strong well-well, dem kon force Amor pipol to work as dia slave. 36 Amor pipol borda start from Skorpion Pass go rish Sela and e still kontinue from der go.