Job
Introdushon
Dis book na about Job and na to help us Ansa di kweshon about how human being dey sofa: Weda na bikos of sin pesin dey sofa or na God make pipol dey sofa? Just like di bad-bad tins wey happen before wey use some pesin take show di ansa to some kweshons about wetin life mean, na so too Job tok about dis tin wey sey God go bless good pipol kon ponish doz wey dey do bad, den doz wey dey live betta life go prosper and doz wey dey do wiked tins, go sofa di ponishment.
Di book show sey Job na betta pesin wey dey do wetin dey rite for God eye and wey dey prosper, but e kon bigin sofa at wons as e get diziz full body and all en shidren kon die finish. But e nor ever curse God and e bilive sey e nor do any bad tin even wen en friends dey sey make e tok wetin e do make God for forgi-am, bikos na sin dey kause dis kind sofa. Di main part for di book na di Hibru songs wey show how Job and en friends tok to one anoda. Di three friends like Job mate and one small boy wey bilive sey Job do wiked tins and na dis make am dey sofa. But Job still sey e nor do any bad tin and e kon beg God make E tink am as e ensef dey tink am (10:3-7). Bikos Job know sey e nor do any bad tin, e kon ask God sey make E judge am or end all di wahala wey dey happen to am. For di last chapters, God kon finally send one strong breeze wey ansa Job many kweshon. God diskribe en divine wisdom and how E take kreate di world. God tell Job sey ordinary human being nor go fit do or tink as God dey tink. God kon safe Job from all wetin en friends dey tok and dis one kon show sey nor bi pesin sin really make am dey sofa all wetin e dey sofa. At di end, Job kon prosper again and en life kon betta pass as e bi before.
1
Job Good Life
E get one man wey dem dey koll Job, e dey stay for Uz land and e dey do wetin God wont. E dey serve God with klean belle and e nor dey do bad tins. E born seven sons and three dotas. E till get 7,000 sheep, 3,000 kamel, 500 oxen, 500 donkey wey bi woman, plenty savant and na-im get money pass for di east side for di kountry.
Job sons dey always do party one-by-one for dia house, wey evribody dey kom chop and drink and dia three sistas dey kom too. One dia party finish, Job go koll and santify dem. For early morning, Job go offa sakrifice for all of dem. “Bikos e bilive sey dem fit nor know sey dem don sin and curse God.” Job dey do dis tin evritime.
Satan Akuse Job
Naw, wen di day rish for God angels to gada before God, Satan follow dem kom too. God ask Satan, “Where yu from dey kom?”
Satan ansa, “I just dey waka anyhow for di world.”
God kon tell Satan, “Yu know my pikin wey dem dey koll Job? Nobody bi like am for di eart; e dey klean and e good well-well. E dey fear mi well-well and e nor dey do bad tins.”
Satan ansa, “Job go gri woship Yu, if e nor get anytin wey e go gain? Yes, Job get good rizin to fear God. 10 Yu dey kover en, en family and all di tins wey e get; Yu bless evritin wey e dey do and Yu don gi-am plenty animals. 11 Just take evritin wey e get from am and e go curse Yu for yor face!”
12 God kon tell Satan, “Okay, evritin wey Job get, dey for yor hand, but make yu nor kill-am!”
So Satan komot from God present.
Satan Take Job Shidren And E Money
13 One day, Job shidren dey do party for dia senior broda house, 14 den leta, one savant run go tell Job sey, “Oga! Wi dey klear di land with yor melu and di donkey dem dey for di oda side, 15 den at wons, Sabean pipol just kom attack and karry all of dem go. Dem kill all di savant and na only mi one eskape kom tell yu.”
16 As e still dey tok, anoda savant run kom kon sey, “Oga! God fire fall kom from heaven kon kill all di sheep and doz wey dey guide dem and na only mi one eskape kom tell yu.”
17 As dis one still dey tok, anoda savant run kom sey, “Oga! Kaldea pipol form three group kom attack us. Dem karry all di kamel kon kill yor savant dem and na only mi one eskape kom tell yu.”
18 Before e tok finish, anoda savant run kom kon sey, “Yor shidren dey do party for dia senior broda house, 19 den one kind strong breeze from di wildaness blow di house fall kon kill all of dem. Naw, na only mi one eskape kom tell yu.”
20 Den Job stand up, tear en klot; barb en hair kon fall face groun. 21 Den e sey,
“Dem nor born mi with anytin
and wen I die, I nor go karry anytin follow body.
Na God dey give and E don take.
Make wi praiz God name!”
22 With all dis tins wey dey happen so, Job nor ever blame, sin or curse God.