5
 1 “Job, make yu koll naw,  
if anybody go ansa yu?  
Na who dey holy wey yu won go meet?   
 2 Na vexnashon dey kill who nor get sense  
and na jealousy dey kill fool.   
 3 I don si sey fool fit dey progress,  
but na wons wahala go kom distroy evritin wey e get.   
 4 Dia shidren nor dey save; no lawyer dey to defend dem for kourt.   
 5 Doz wey dey hongry go chop wetin di fool dem plant;  
grass go grow kover wetin dem plant.  
Pipol wey get long-trot, go tif dia propaty.   
 6 Evil nor dey grow from dust  
or trobol from groun.   
 7 But just as lite dey shine go up,  
na so too dem born pesin enter trobol.   
Di Blessing 
  8 “But if na mi, I go look for God  
kon komplain gi-am.   
 9 Wi nor go fit know di great tins wey E dey do  
and en wonders nor get end.   
 10 E dey give rain to di eart  
and wota for di san.   
 11 Na God dey karry doz wey dey honbol go up  
and give joy to doz wey dey mourn.   
 12 E skata and make sure sey wayo pipol  
nor fit do wetin dem plan!   
 13 E dey katch pipol wey feel sey na dem get sense pass  
kon end dia wayo work.   
 14 Dem dey waka for darkness for day time.  
For aftanoon, dem dey waka dey find road  
like sey dem dey darkness.   
 15 But na God dey save poor pipol from deat.  
E dey save doz wey nor get,  
from doz wey get pawa.   
 16 E dey give hope to di poor  
kon silent wiked pipol.   
 17 Na blessing dey follow di man wey God korrect!  
So make yu nor komplain wen God dey ponish yu for yor sins.   
 18 God go kover where E for wound yu;  
na en hand wound yu  
and na dat same hand E go take heal yu.   
 19 E go save yu from trobol six times  
and wen e rish di sevent one,  
evil pipol nor go fit tosh yu.   
 20 Wen honga kom, E go keep yu alive;  
wen war kom, E go protet yu, so dat yu nor go die.   
 21 God go diliver yu from trobol;  
E go save yu wen distroshon kom.   
 22 Yu go laf trobol and honga;  
yu nor go fear wiked animals again.   
 23 Di land wey yu klear go dey free from stones  
and wild animals nor go kom near am.   
 24 Peace go dey yor house  
and wen yu look yor propaty,  
evritin go komplete.   
 25 Yu go get many shidren!  
Dem go plenty like grass for dis eart.   
 26 Just as rice dey wait until den won harvest am,  
na so too yu go old before yu die.   
 27 Job, wi don study dis tin wey dey happen  
and wi know sey na true.  
So, hear dis words make yu use am for yor own good.”