18
Bildad Still Tok 
  1 Bildad wey kom from shuh kon sey:   
 2 “Job, wen yu go stop to dey tok?  
If yu stop, wi go tok to yu.   
 3 Wetin make yu dey feel sey wi  
nor get sense like animals?   
 4 Yu just dey kill yorsef with vexnashon.  
Make di eart skata, bikos yu dey vex?  
Abi make mountins shake komot where e dey?   
 5 Wiked pipol lite go soon off;  
dia fire nor go ever burn again.   
 6 Di lite for dia house go dark;  
di lantan wey dey dia room go off.   
 7 Dem dey waka well before,  
but naw, dem go dey stagga;  
na dia own advise go distroy dem.   
 8 Wiked pipol go waka enter net  
and e go katch dia leg.   
 9 Trap go katch dia leg  
kon hold dem for der.   
 10 Dem hide rope for dem for groun  
kon set trap for where dem go waka pass.   
 11 Fear dey wait dem for evriwhere  
and e go follow dem as dem dey waka.   
 12 Sofa dey hongry dem;  
wahala dey wait for dem to fall.   
 13 Sickness don chop dia body finish  
and na dis make dia hands and legs dey rotin.   
 14 Dem don skata di house where dem for dey save and naw,  
na di king wey dey make pesin fear,  
go judge dem.   
 15 Fire go burn wiked pipol house.  
Yes fire with sulfur don skata dia house rish groun?   
 16 Dia rut don dry finish  
and dia branches go skata.   
 17 Pipol nor go remember dem for dia house or for outside again,  
bikos dia name don fade komot from di land.   
 18 Dem go porshu dem from where pipol stay  
kon still porshu dem from lite enter darkness.   
 19 Dem nor get shidren, grand-shidren  
or pesin wey go live afta dem don die.   
 20 From east go west,  
evribody wey hear wetin happen to dem,  
go fear kon sey,   
 21 ‘True-true, na so wiked pipol house dey bi  
and pipol wey nor know God,  
na dem dey stay dis kind place.’ ”