28
Wisdom 
  1 Job sey,  
“Where dem for dey dig silva, na der precious stones dey  
and e still get where dem for dey rifine gold too.   
 2 Na from groun dem for dey dig iron  
and melt koppa.   
 3 Man don end darkness,  
bikos dem shine lite dey search under di eart  
and dey dig rock wey dey for darkness.   
 4 Where dem for dig di precious stones  
dey far from where pipol dey stay  
and nobody dey travel pass der again.  
Dem dey stagga fall  
and pipol nor dey der.   
 5 Even doh food dey kom from di eart,  
evriwhere under di eart,  
don skata like wetin fire burn.   
 6 Na betta stone dey di eart  
and gold dey en dust.   
 7 No bird know di road wey lead to where gold dey  
and know vulture don fly pass or si am before.   
 8 No lion or oda wiked animals fit travel  
pass dat road wons.   
 9 Pipol dig di rock and mountins wey hard pass  
bikos dem dey find gold.   
 10 As dem dey dig hold for di rock,  
dem kom si precious stones.   
 11 Dem dig rish wota kon bring wetin dem hide,  
kom out for lite.   
No Money Fit Buy Wisdom 
  12 “But where wi go fit si wisdom?  
Where wi go fit learn how to undastand?   
 13 Yu nor fit si wisdom with human being;  
bikos e nor dey among pipol wey dey alive.   
 14 Even bottom river sey,  
‘E nor dey with mi’  
and under sea sey,  
‘E nor dey with mi too.’   
 15 Dem nor go fit buy wisdom  
with gold or silva.   
 16 Di gold and jewel wey fine pass  
nor get value rish wisdom.   
 17 Wisdom dey more important pass gold;  
e even dear pass where gold full or where fine glass dey.   
 18 Wisdom get betta value pass diamond  
or fine glass.   
 19 Topaz stone wey fine pass and di gold wey klean pass,  
dem nor fit kompare dem with wisdom.   
Na Only God Get Wisdom 
  20 “But where wisdom from kom sef?  
Where wi go for fit learn how to undastand?   
 21 Nor-tin wey dey live for dis life fit si wisdom,  
even di birds wey dey fly nor fit si am.   
 22 Deat and distroshon agri sey,  
na hear dem just dey hear.   
 23 Na only God know di way  
and place where dem fit si wisdom,   
 24 bikos E dey si di end for di eart  
and E dey si evritin wey dey under di sky.   
 25 Na God give breeze pawa  
kon measure where di sea go rish.   
 26 Na God dey choose where di rain go fall rish  
and where tonda go travel pass.   
 27 Na der E si wisdom kon test as e important rish,  
den E si sey e dey good.   
 28 God tell human being,  
‘Before una go get sense, una must woship mi.  
Una go turn live bad tins,  
before una go fit get undastandin.’ ”