34
Elihu Still Tok 
  1 Elihu still sey:   
 2 “Wise men, make una listin to my words;  
Make una hear mi, men wey know well-well.   
 3 Una know betta food wen una put am for mout,  
but una ear nor know wise word wen e hear am.   
 4 So make wi choose wetin dey rite.  
Make wi know among awasef wetin dey good.   
 5 Job sey en know do bad tin  
and God nor gri defend am.   
 6 E sey, ‘As I dey rite so, make I lie sey I dey wrong?  
Dem nor fit heal my wound, even doh I nor sin at-all.’   
 7 Yu don si any man wey bi like Job  
wey dey tok anyhow?   
 8 E like make bad pipol dey stay with am  
and e dey waka with sinnas.   
 9 E sey pesin nor dey gain anytin,  
if e dey obey God.   
God Nor Dey Judge Anyhow 
  10 “Men wey dey undastand, make una listin to mi!  
God Almighty go fit do wetin dey wrong?   
 11 E dey reward pipol for wetin dem do  
and dey trit dem as dem deserve.   
 12 True-true, God nor dey do bad tin;  
E dey judge evribody as e suppose bi.   
 13 Abi God get en pawa for anoda place?  
Na somebody tell am sey make E kare for di world?   
 14 If God remove di breath  
wey dey give us life,   
 15 den evribody wey dey live for dis life go die  
kon turn to san.   
Na God Dey Rite 
  16 “Naw, make yu listin to mi.  
If yu get undastandin, make yu hear mi.   
 17 So yu dey tok sey God nor dey rite naw?  
Yu feel sey E hate justice?   
 18 God dey kondemn kings and rulers  
wey wiked and nor dey yuzful.   
 19 E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol,  
bikos na-im kreate all of dem.   
 20 Pesin fit die for nite just like dat,  
but God nor dey struggol to distroy pipol  
wey tink sey dem get pawa.   
 21 God dey si evritin wey wi dey do.  
E dey si evry step wey wi take.   
 22 E nor get as di darkness tick rish,  
e nor fit hide sinnas from God.   
 23 Wi nor fit set di time  
wey God go take judge all of us.   
 24 E nor nid pesin to tell am anytin, before E go remove leader  
kon put anoda pesin for en post.   
 25 Bikos E know wetin di leader do.  
E fit ova-trow and skata dem for nite.   
 26 E dey ponish sinnas bikos of dia sin  
and na for where evribody go for si dem,   
 27 bikos dem don stop  
to follow en laws and kommand.   
 28 Dem make poor pipol dey kry to God  
and E don hear dia koll for help.   
 29 If God sey E nor go do anytin,  
nobody go fit ask am kweshon.  
If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin  
or di hold kountry.   
 30 God dey do like dis, so dat wiked pipol nor go rule  
and opress di pipol.   
Job Dey Foolish To Vex 
  31 “Wetin make pipol nor dey konfess dia sins give God  
kon promise sey dem nor go sin again;   
 32 den tell mi my fault  
so dat I nor go do dem again?   
 33 Job! Na yor choice,  
nor bi mi go tell God wetin yu wont,  
bikos yu don rijet all dis tin.  
Naw, make yu tell us  
wetin yu dey tink.   
 34 True-true, anybody wey get sense go gri  
and if wise man hear mi, e go tok sey,   
 35 Job just dey tok,  
bikos e nor know wetin e dey tok  
and all wetin e dey tok,  
nor make sense.   
 36 But I wish sey dem test Job rish di end,  
bikos e dey ansa like wiked pesin.   
 37 E don add trobol join e sins,  
bikos for awa front,  
e dey klap en hand and dey akuiz God.”