36
Elihu Still Dey Tok 
  1 Elihu still sey:   
 2 “Make yu relax and listin to mi small,  
bikos I still get some tins to tok for God,  
as E nor dey here with us.   
 3 I go use wetin I know take show sey God dey rite.  
I go tok di ones wey I know.   
 4 My words nor bi lie;  
na betta wise man stand for yor front so.   
 5 True-true, God strong well-well!  
E nor dey feel sey pesin nor dey yuzful  
and e nor get anytin wey E nor undastand.   
 6 E nor dey give wiked pipol long life,  
but E dey judge well for poor pipol.   
 7 E dey protet good pipol;  
E dey let dem live like kings  
and pipol dey respet dem forever.   
 8 But if dem shain dem inside prison  
and dem dey sofa,  
bikos of wetin dem do,   
 9 God go show dem di rizin.  
E go show dem dia sin and pride.   
 10 E go make dem listin to en warnin,  
so dat dem go leave wiked tins.   
 11 If dem hear God word kon serve am,  
dia life go get peace and dem go prosper.   
 12 But if dem nor gri listin to God word,  
dem go die and dem nor know anytin  
before dem go where dead body dey.   
 13 Pipol wey nor know God go just dey vex  
and even wen E ponish dem,  
dem nor go sey make E sorry for dem.   
 14 Dem dey die wen dem still yong  
and na disgrace dey end dia life.   
 15 But God use sofa take dey tish  
and save en pipol kon korrect dem with pain.   
 16 God remove yu from trobol  
kon make yu dey save  
and yu get food full yor tabol.   
 17 But naw, yu dey get di kind ponishment  
wey fit yu.   
 18 Make yu dey kareful,  
so dat dem nor go fool yu with money  
or sey yu follow money go di wrong way.   
 19 E nor go do yu any good sey yu dey kry for help;  
bikos yu get betta pawa wey nor fit help yu.   
 20 Nor dey wait for nite,  
wen pipol don go dia house.   
 21 Make yu dey kareful,  
so dat yu nor go do bad tin,  
bikos yu dey sofa.   
 22 Make yu remember how God strong rish,  
bikos na-im dey tish tishas.   
 23 Nobody fit kommand God  
or akuiz am sey E do bad tin.   
 24 Na praiz pipol dey always praiz am for anytin wey E do.  
So, yusef must praiz am.   
 25 Evribody don si wetin E do!  
Na from far wi dey look am.   
God Wisdom And Work 
  26 “Wi nor fit know how God strong rish.  
Wi nor fit search or kount how many years God don dey.   
 27 Na God dey take wota from di eart  
kon turn am to rain.   
 28 E dey let di rain fall from di kloud,  
so dat pipol go prosper as dem dey work.   
 29 Nobody know how tonda take dey make nois for di sky  
or how kloud take dey waka  
for heaven where God dey.   
 30 E dey send lite pass di sky,  
but under di sea dey-dey dark.   
 31 Dis na how E dey feed  
and provide plenty food for pipol to chop.   
 32 Na en hand E take dey stop tonda lite  
kon send am go where E wont.   
 33 Even animals know sey tonda  
kom before heavy rain dey fall.