Jonah
Introdushon
Dis book na about God and Profet Jonah for 8th century BC wen King Jeroboam II dey rule Judah. Di book nor bi like di oda profets writing. E nor tok about vishon or message to Judah or di oda nashons but na about di drama between God and Jonah ensef. Na only one message dey dis intrestin book. Di story na about how God tell Jonah make e go warn Nineveh pipol sey E go distroy dia land bikos of dia sin. Na two main parts dey di drama. Di first one start as God dey repeat en kommand to Jonah make e go prish for di great town, Nineveh. Instead, Jonah go enter one ship wey dey go Tarshish, bikos e won hide from God and nor won go where God send am. Di sekond part happen wen Jonah dey inside one big fish belle. Afta God kommand di fish to vomit Jonah for Nineveh, Jonah go prish der and di pipol kon turn from dia sins go meet God, While di sekond part dey inside first one, di sekond part happen for Nineveh town wen Jonah nor dey happy bikos God get pity for di pipol. Jonah akshon for dis book na to show how pipol for Israel dey bihave to oda nashons. Instead make dem help oda nashons to know God just as E tell dem, so dat dem go dey save, dem dey si dis nashons as dia enemies and dey espect sey God go distroy doz nashons. Di book tish us sey, apart from Israel pipol, God still love di oda nashons. In-short, di message bi sey, God love di whole world.
1
Jonah Run From God
One day, God tell Jonah wey bi Amittai pikin sey, “Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol about my judgement wey dey kom, bikos I don hear how di pipol for der wiked rish.” But Jonah kon plan to run go anoda place, bikos e nor won do wetin God tell am. E travel go Joppa where e for si one ship wey karry load dey go Tarshish. So e buy tiket kon enter di ship, so dat e go fit hide from God. But God send strong breeze go kause wahala for di sea and bikos di breeze strong well-well, di ship won kon break to pieces. Di sailors kon dey fear; evribody bigin kry kon dey pray to dia difren juju. Den dem kon dey trowey dia load for wota make di ship for lite. By dis time, Jonah dey inside-inside di ship dey sleep. Wen di kaptain for di ship si am, e kon wake and ask am, “How kom yu fit dey sleep for dis kind time? Make yu get up kon pray to yor God make E kom help us. May bi E go sorry for us kon save awa life.” So di sailors kon sey, “Make wi trow dice take know di pesin wey dey kause dis wahala for us.” So dem trow dice and e kon show sey na Jonah dey kause am. Dem kon sey, “Make yu tell us! Na who make dis tins dey happen to us so? Na wish kind work yu dey do? Where yu from kom? Wetin bi yor kountry name and wish tribe yu bi?” Jonah ansa, “I bi Hibru pesin! I dey woship God; di Pesin wey make heaven, land and sea.” 10 Wen dem hear wetin e tok, fear kon katch dem well-well, so dem ask am, “Wish kind tin yu do so?” Di men tok like dis, bikos dem know sey e dey run from God, just as e bin tell dem. 11 Bikos di breeze dey strong more-more, dem kon ask am, “Wetin wi go do yu naw make dis breeze for stop?” 12 Jonah ansa, “Make una trow mi inside di wota and di breeze go stop. Bikos na mi kause dis wahala for una.” 13 Instead, dem kon try to padol di ship go land back, but dem know fit, bikos di breeze strong well-well. 14 So dem kry to God sey, “God wey get pawa, wi beg, make Yu know let us die, bikos of dis man! Make Yu know ponish us sey wi kill dis innocent man, bikos Yu wey bi Oga God, must do wetin Yu wont.” 15 So dem trow Jonah inside di wota, den di breeze kon stop. 16 Dis tin make di men fear God well-well, so dem offa sakrifice gi-am kon promise to serve am.
17 So God send one big fish go swallow Jonah. Jonah dey di fish belle for three days and three nite.