56
Prayer To Trust God
David Song Wen Filistia Pipol Dey Porshu Am
1 My God, make Yu sorry for mi,
bikos pipol dey attack mi.
My enemies dey attack mi evriday.
2 Pipol wey won si sey I fall,
dey always attack mi.
True-true many of dem
dey fight mi.
3 But even as I dey fear,
I still trust Yu.
4 I praiz God for wetin E don promise.
I trust God, so wetin go make mi dey fear?
5 Evriday, dem dey kause wahala for mi.
All wetin dem sabi, na to dey plan bad tins against mi.
6 Dem dey gada hide dey look mi;
dey monitor mi as I dey waka and dem dey ready to kill mi.
7 So my God, make Yu distroy dem
bikos of di bad tins wey dem dey do.
Make Yu nor let dem eskape!
8 Yu know di pains wey I dey face.
As I dey kry, Yu put all my tear for bottol
kon rite wetin I dey sofa for yor book.
9 My enemies go run wen I koll Yu for help,
bikos I know sey God dey for my side!
10 I dey praiz God for wetin E don promise.
Yes! I go dey praiz am, bikos of en promise.
11 I trust God well-well, so wetin go make mi dey fear?
Wetin ordinary human being go fit do mi?
12 My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu,
bikos of how Yu dey help mi.
13 Yu don save mi from deat and Yu nor let mi fall at-all,
so I go always dey serve Yu, as I dey enjoy dis life.