124
Na God Dey Protet En Pipol
David Song
1 Make Israel pipol sey,
“If to sey Oga God nor dey awa side?”
2 If to sey God nor really dey awa side
wen pipol attack us,
3 dem for don swallow us
alive as dem dey vex.
4 River for don kover us;
wota for don karry us go.
5 Strong wave for river
for don kover awa soul.
6 So, make wi praiz God
wey nor let awa enemies tear us to pieces with dia tit!
7 Wi don eskape like bird
wey komot from hunta trap.
Dia trap and net wey dem set for us,
don break and wi don dey free!
8 God wey kreate heaven and eart,
na-im diliver us from dia hand.