Zefanaya
Introdushon
Wen Manasseh bi king for Judah, Judah pipol kon do many bad tins pass: like koroupshon, wikedness and dey serve oda gods. But wen Manasseh grand-pikin, Josaya dey rule, e kon bring di pipol back to God and Judah kon dey rule demsef. Dis happen bikos one pesin among di leaders for Josaya palis stand up kon warn dem, sey di kovenant wey Judah pipol break so, go distroy dem if dem nor turn go meet God. And dat pesin wey warn dem so, na Profet Zefanaya. Di book diskribe Zefanaya as Hezekaya great-great grand-pikin and e bi one profet wey wi fit trace en family go back to en grand-grand papa. Di book show how Zefanaya and di king bring di pipol kom back to God. E bi like sey Zefanaya get royal blood for body, bikos e know many places, pipol and major activities for Jerusalem town. E diskribe how di day go bi, wen God go judge Jerusalem and Judah pipol.
Na three parts dey di profesy. Di first one diskribe how tins go happen for di day wen God go judge Judah and Jerusalem pipol. Di next part tok to di pipol, sey make dem turn from sin kom meet God and di distroshon wey dey kom to Filistia, Moab, Kush (Ethiopia pipol), Assyria and Jerusalem pipol. For di final part, Zefanaya promise sey God go make di pipol wey remain dey humbol wen E go kom back as Strong Warrior among di pipol.
1
Dis na di message wey God give Zefanaya for di time wey Amon pikin, Josaya bi king for Judah. Kushi wey bi Gedalaya pikin, naim bi Zefanaya papa and na Amaraya wey bi Hezekaya pikin, born Gedalaya.
Judgement Warnin
God sey,
“I go swip evritin komot from dis eart.
I go swip both pipol and animals.
I go distroy di birds for di sky
and di fish for sea.
I go turn wiked pipol place
to where dem dey trowey dirty put
kon distroy human being komot from dis eart.
Na with my hand I go take skata Judah,
Jerusalem and evritin wey koncern di Baal juju
wey dem dey woship.
I go distroy all dia wiked priests
and nobody go remember dem again,
bikos dem klimb on-top dia house
go bow for di sun, moon and stars.
Dem dey klaim sey dem dey follow God,
but dem still dey woship Molek juju.
I go distroy doz wey bin dey woship mi,
but nor dey woship mi again.
Dem nor dey ask make God guide or bless dem again.”
So make una stand for God wey get pawa front,
bikos di wonderful day wen God go judge di world,
don near.
God don prepare to distroy en pipol
and E don choose who go kill dem.
God sey,
“For judgement day, I go ponish Judah leaders,
all dia prince and all doz wey dey sin.
For dat day, I go ponish di pipol
wey dey serve juju
and wey turn dia oga house
to where dem dey kworel and play pipol wayo.”
10 God sey,
“For dat day, pipol go kry dey kom from di Fish Gate
and dem go dey shaut from di new house
dem wey dey di town.
And una go hear strong nois from di hills.
11 All of una wey dey stay near di market,
make una kry with pain,
bikos I go distroy all doz wey dey sell and buy.
12 I go use lantan take find all Jerusalem korna
wey darkness pass,
so dat I go ponish doz wey love to sin.
Dem bilive sey God nor go fit do dem anytin;
weda good or bad.
13 So, pipol go tif and karry dia propaty
kon skata dia house.
Dem go build new house,
but dem nor go ever stay inside.
Dem go plant vineyard,
but dem nor go ever drink from di wine.
14 Di day wey God go make evribody fear, don near.
E go kom kwik-kwik and nobody go like am,
bikos for dat day, even strong men go kry.
15 Dat day, God go vex well-well and di wahala
and pain nor go eazy at-all.
Dat day go bi to skata and distroy;
day wen evriwhere go dark well-well.
Yes! Dat day go kom with tick kloud and darkness.
16 For dat day, trumpet go dey blow
and war go dey evriwhere.
Evriwhere for di town go dey shake;
even di walls wey strong well-well, go fall skata!
17 Bikos una don sin against God,
I go make una waka dey find road like blind man.
Dem go pour una blood for san-san
and una body go rotin for groun.”
18 Una gold and silva nor go save una
wen God go show as E dey vex rish.
En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world.
Yes, na God make evribody for di world dey fear.