12
Woship Place
Dis na di rules and laws wey una must obey, wen una don enter di land wey una grand-grand papa God, dey give una. As long as una dey alive, una must obey dem. Wen una porshu di kountries wey dey der, una must distroy all di place wey dem for dey woship dia gods, both for di mountin, on-top di hill and under evry tree. Make una break di altars and skata di pilas. Make una burn di Asherah juju poles kon kut dia juju. Make una make sure sey una distroy all dia gods!
Make una nor woship di Oga una God just as dis pagans dey woship dia gods, but una must woship di Oga una God for where en ensef go choose from among all di tribes and na der una go for honor en name. For der, una go karry burnt ofrin, sakrifice, vow ofrin, ordinary ofrin and una ofrin for di first fruit and animals wey una get. For der, una with una family go chop for di Oga una God present and una go happy for evritin wey una get, bikos di Oga una God don bless una.
Una nor go woship God as wi dey do for here today, where evribody dey do as dem like, bikos una neva even rish where una dey go kon kollect di land wey di Oga una God dey give una. 10 Wen una don cross Jordan River kon kollect and stay for di land; wen God don give una rest from all una enemies and una dey save for di land, 11 una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name. 12 For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una). 13 Make una dey kareful, so dat una nor go sakrifice una burnt ofrin for anywhere wey una like. 14 Una go only sakrifice am for di place wey God go choose from among una tribe. Na der una go for offa una burnt ofrin and do evritin wey I kommand una.
Animal For Food
15 But una fit kill una animals kon chop en meat for any town wey una wont. Una fit chop di animal wey God give una as una like. All of una, weda una dey klean or not, fit chop meat, just as una dey chop gazelle and deer. 16 But una must nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota. 17 But make una nor chop ofrin for una own town or tithe for una harvest and for una first fruit or animal, or sakrifice ofrin and vow ofrin. 18 Una must chop dis tins for di Oga una God present and e go bi for di place wey E choose. Make una chop for der with una shidren and Levi wey dey stay with una and for evritin wey una dey do, make una dey celebrate for di Oga una God present. 19 As long as una dey dis land, make una dey kareful as una dey kare for Levi shidren.
Blood
20 Wen di Oga una God don make una land big as E sey E go do and una like to chop meat, una dey free to chop as una like. 21 If di place wey God choose sey una go woship am too far for una, una fit kill any of una animal wey E don give una, just as I kommand una; kon chop dem for una town as una like. 22 Just as una dey chop gazelle or deer; doz wey dey klean and doz wey nor dey klean, fit chop dem too. 23 But make una nor chop blood, bikos blood na life and una must nor chop animal blood with di meat. 24 Instead, make una pour di blood for groun like wota. 25 Make una nor chop di blood, so dat evritin go dey well with una and una shidren-shidren and if una do like dat, belle go sweet God.
26 But make una take di holy ofrin and di vow wey una make, go di place where God choose. 27 Di meat and blood from una burnt ofrin, make una put am for di Oga una God altar. Make una pour di oda sakrifice blood for di Oga una God altar, but una fit chop di meat. 28 Make una make sure sey una obey all di kommand wey I dey give una, so dat evritin go dey well with una and una shidren-shidren, bikos una do wetin dey good and betta for una Oga God eye.
29 Wen di Oga una God dey go for una front go distroy all di kountries and una drive dem komot kon stay di land, 30 make una nor follow dem serve dia juju and gods. Make una nor ask about dia gods or sey, “Na how dis pipol take dey woship dia gods? Make wi serve God like dem.” 31 Una must nor woship di Oga una God, just as di oda kountry dey woship dia own gods, bikos all wetin dem dey do take woship dia gods, na tins wey una Oga God hate well-well. Dem even dey burn dia shidren as sakrifice for dia gods.
32 So all dis kommand wey I dey give una so, make una obey dem with kare. Make una nor add join or remove from dem.