2
Israel Pipol Journey
Den wi turn kon travel pass di wildaness go di Red Sea, just as God kommand mi and wi kon dey waka anyhow round Mount Seir for many days.
At last, God kon tell mi, “Una don too waka round dis mountin, so make una turn face nort. Make yu give dis kommand to di pipol: ‘Una go soon cross una pipol Edom kountry, wey una broda Esau bi dia grand-grand papa and dem dey stay for Seir. Edom pipol go dey fear una so make una dey kareful. Make una nor borda dem at-all, bikos I nor go give una any of dia land, bikos na di whole Mount Seir land I give Esau dia grand-grand papa. Una fit buy food chop from dem and wota to drink from dem too.
“ ‘Di Oga wey bi una God don bless una for evritin wey una dey do. Evry step wey una take for di great wildaness, I dey with una. For dis forty years wey una dey dis wildaness, God dey with una and una get evritin.’ ”
So wi nor kon follow Edom, Esau pipol kountry wey dey for Mount Seir. Wi nor pass thru Arabah Valley wey kom from Elat and Ezion-Geber, but wi travel pass Moab dirty land.
Den God tell mi, “Make una nor let Moab pipol wey bi Lot shidren-shidren vex. Make una nor kause wetin go make dem won fight una, bikos I nor go give una any of dia land, bikos I don give Ar to Lot shidren-shidren.
10 “(Emim pipol dey stay der before; pipol wey get betta pawa many well-well for der and dem tall like Anak pipol. 11 Na Refah and Anak dem still dey koll dis pipol; but Moab pipol dey koll dem Emim. 12 Before-before, na Hor pipol dey stay for Seir, but Esau shidren-shidren drive and distroy dem, den kon stay der, just as Israel pipol do to di land wey dem take and na God give dem dis land.)”
13 God sey, “Naw, make una cross go River Zered.” So wi kon do as E tok.
14 Na thirty-eight years e take us to cross from Kadesh Barnea go River Zered and dat time, all di sojas for dat generashon die finish, just as God tell dem. 15 True-true, na God kill all of dem finish with en own hand for di kamp.
Israel Pipol Travel Pass Ammon
16 So wen all di sojas don die finish among di pipol, 17 God kon tell mi, 18 “Today, una go cross pass Moab pipol borda wey bi Ar land. 19 But wen una don near Ammon pipol, make una nor let dem vex won kon fight una, bikos I nor go give una any of dia land; bikos I don already gi-am to Lot shidren-shidren.
20 “(Before-before, dem sey na Refah pipol dey stay der. Na Refah pipol really dey stay der; Ammon pipol dey koll dem Zamzum. 21 Dem strong; many well-well and dem tall like Anak pipol. But God distroy Refah pipol, bikos of Ammon pipol, so dat dem go fit stay for der. 22 Dis na wetin E do for Esau shidren-shidren for Seir, wen E distroy Hor pipol, so dat dem go fit stay for der till today. 23 But for Avvim pipol wey kom form Krete and dey stay di west side for Gaza and Kaftor pipol aria, make una distroy and take dia land.)
24 “So make una cross go River Arnon. Si! I don already give una Sihon wey bi Amor king for Heshbon and all en land. So make una go fight and take di land from am! 25 From today, evribody wey dey di world, I go put fear for dia mind, bikos of una and even wen dem hear una name, fear go katch dem. Dem go fear nearly die wen dem hear sey una dey kom.”
Israel Pipol And Sihon
26 So I send messenja from Kedemot wildaness go meet King Sihon for Heshbon with peace sey: 27 “Make wi pass thru yor land and wi nor go tosh or take anytin from am; wi nor go even turn rite or left. 28 Yu go sell food and wota give us, so dat wi go chop and drink. Make yu just allow us waka pass, 29 just as Esau shidren-shidren wey dey stay Seir and Moab pipol wey dey stay for Ar allow us pass. Make wi just pass until wi go cross Jordan River go rish di land wey di Oga awa God dey give us.” 30 But King Sihon for Heshbon nor gri, bikos na so God wont make e bi, so dat E go fit give di land to us today.
31 God tell mi sey, “Si! I don already give una King Sihon and en land. So make una take di land as una own.”
32 Wen King Sihon and all en sojas gada kon fight us for Jahaz, 33 di Oga awa God put dem for awa hand and wi kill dem, plus dia sons and evry oda pesin. 34 For dat time, wi take all di towns kon judge di pipol as God wont am, plus di wimen and shidren, den wi kon kill all of dem. 35 But wi keep di animals for awasef. 36 From Aroer wey dey River Arnon korna (River town), go rish Gilead, e nor get any town wey fit fight us. Di Oga awa God give us all doz towns. 37 Aldo wi nor go Ammon pipol land, River Jabbok, di town for di hill or any place wey God sey make wi nor go.