28
Di Blessing
If una really obey God kon keep en kommand wey I dey give una today, di Oga una God go make una high pass all di pipol for di world. Una go get all dis blessings if una obey di Oga una God.
God go bless una towns and una fields.
God go bless una shidren and una plants. E go still bless una animals and dia pikin wey dem go born.
E go bless una basket and una plate.
Anywhere wey una go and anytin wey una dey do, God go bless am.
God go make una win una enemies wen dem attack una. Dem go from one side attack una, but dem go skata and run from una for seven side!
God go kommand blessing for una aria and for evritin wey una dey do; yes, E go bless una for di land wey E dey give una.
If una obey di Oga una God kommand kon do as E tok, E go make una en holy pipol, just as E promise sey e go bi. 10 Den evribody for di eart go si sey una bilong to God and dem go respet una. 11 God go make una shidren, animal and plant many kon make una prosper for di land wey E promise una grand-grand papa sey, E go give una.
12 God go send rain from en rish store kom meet una for di rite time and E go bless all di work wey una dey do. Una go dey give to many kountries, but una nor go ever borrow from dem. 13 If una listin well to di Oga una God kommand and if una obey dem with kare, God go make una bi di head and nor bi tail and una go always dey on-top and nor dey under. 14 Make una nor turn from any of dis kommand wey I dey give una today or go follow and woship oda gods.
Curse
15 But if una forget di Oga una God and una nor gri obey en kommand and laws wey I dey give una today, den all dis curse go kom meet una with full force:
16 God go curse una towns and fields.
17 E go curse una basket and una plate.
18 God go curse una shidren and una plants. E go still curse una animals and dia pikin wey dem go born. 19 Anywhere wey una go and anytin wey una dey do, God go curse am.
Curse With Diziz
20 Na God by ensef go send curse, problem, wahala, konfushon and E go dey fight una for evritin wey una dey do, until una skata and die finish, bikos of di wiked tins wey una dey do and bikos una don turn from am. 21 God go send diziz kom meet una, until nor of una go remain for di land wey una go soon enter go stay. 22 God go kill una with bad diziz, fever, sore, kro-kro and kold. Dis diziz go attack una until una die finish. 23 Di sky on-top una head go strong like bronze and di eart under una leg go strong like iron. 24 God go turn una rain wey dey fall for una land to powder and san-san; e go fall on-top una until una die finish.
Una Go Sofa
25 God go still allow una enemies beat una; una go attack dem from one side, but una go run komot seven side, den all pipol for di eart go dey fear bikos of wetin hapun to una. 26 Una dead body go bi food for di birds for sky and for wiked animal for di eart and nobody go fit porshu dem. 27 God go ponish una with boil from Egypt, some part for una body go swell-up, eczema, ring worm and kro-kro go full una body and dem nor go fit cure una. 28 God go ponish una with madness, una eyes go blind and E go konfuse una mind. 29 For aftanoon, una go dey find road to pass like blind pipol and doz wey dey darkness and una go dey fail for evritin wey una dey do. Pipol go always dey tif una tin and opress una and nobody go save una.
30 Di woman wey una dey won marry, anoda man go rape am. Una go build house, but una nor go fit stay inside. Una go plant vineyard, but una nor go chop dia fruit. 31 Dem go kill una melu for una own eye, but una nor go chop for inside. Dem go tif una donkey for una eye and dem nor go bring dem kom back. Dem go give all una sheep to una enemies and nobody go dey to save una. 32 God go give una shidren to oda pipol and even as una dey look dis tins, una nor go get pawa to do anytin. 33 Strenjas go kom chop di plants wey una sofa plant and dem go opress una still una die. 34 All dis tins wey dey happen go make una mad. 35 God go make boil wey dem nor fit cure, katch una knee and legs. In-short, di boil go kover una from head go rish una leg.
36 God go karry una with di king go meet pipol wey una with una grand-grand papa neva hear of before and una go serve and woship gods wey dem make with wood and stone. 37 For di place where God go send una go, una go bi disgrace among di pipol for di eart.
38 Una go plant plenty seed, but na small tin una go harvest, bikos siti-siti go chop evritin wey una plant. 39 Una go plant and kare for una vineyard, but una nor go drink di wine or chop di grapes, bikos worm go distroy evritin. 40 Una go plant olive tree for una land, but una nor go ever use di olive oil, bikos di fruits go drop before e ripe. 41 Una go get shidren, but dem go die finish, bikos dem go katch dem as slaves go anoda kountry. 42 Wiked insect go distroy una trees and plants.
43 Di strenjas wey dey among una go dey strong well-well, while una go dey weak evriday. 44 Dem go dey borrow una money, but una nor go borrow anybody. Dem go bi head and una go bi tail!
45 If una nor gri listin to di Oga una God or obey en kommand and law wey E give una, all dis curse go porshu una, until e distroy all of una. 46 Di curse go bi sign against una and una shidren-shidren forever.
War Curse
47 Bikos una nor gri serve di Oga una God with betta heart and mind for di good tins wey E do for una, 48 una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.
49 God go bring some pipol from far against una and dem go kill una like vulture. And dem bi pipol wey una nor go undastand wetin dem dey tok; 50 pipol wey wiked well-well and dem nor go respet una old pipol or pity for una yong ones. 51 Dem go chop una animals pikin and una plants, den dem go distroy una. Dem nor go leave any korn, new wine, olive oil or animals for una and una go hongry die. 52 Dem go attack una towns until all di strong walls, (di walls wey una trust sey go protet una) go fall rish groun. Dem go attack all di towns for di land wey di Oga una God don give una.
53 Bikos of di honga and ponishment wey una enemies put una, una go dey chop una own shidren wey di Oga una God give una. 54 Di man among una wey kwayet pass, go turn kon attack en broda, en wife and en shidren wey remain. 55 En own shidren flesh wey e dey chop, e nor go give anybody as nor-tin dey to chop, bikos of di wahala and honga wey di enemy put una for una own town. 56 Di woman wey dey kwayet and gentol among una, wey nor go even put en leg for groun, bikos of how e fine rish, go turn kon attack en husband and shidren 57 and e go chop some since nor-tin dey to chop, bikos of di wahala and honga wey di enemies put una for una own town.
Kovenant Curse
58 “If una nor gri obey my law, di tins wey dem rite for dis book or una nor gri fear di Oga una God wonderful name, 59 God go make una and una shidren-shidren ponishment many and di ponishment go tey well-well. 60 E go give una all doz diziz wey una dey fear for Egypt and dem go trobol una forever. 61 Di Oga una God go still ponish una with difren sickness wey nor dey join dis ones and E go dey bring dem kom, until una don die finish. 62 Even doh una many like di stars for sky, na only some of una go remain, bikos una nor gri listin to God. 63 Just as e sweet God to prosper and make una plenty, na so too God go dey happy to distroy una.
“E go remove una from di land wey una won enter go stay, 64 bikos God go skata una among many kountries from one end for di eart go rish di oda end. For der, una go woship gods wey una or una grand-grand papa nor know before; gods wey dem make with wood and stones! 65 For dat kountry, una nor go get peace or rest. And God go make una heart dey fear; una eye nor go dey si well and una soul go dey worry. 66 Na so-so fear una go dey fear both for day time and for nite, bikos una nor know wen una go die. 67 For morning time, una go sey, ‘If to sey na evening wi dey’ and for evening time, una go sey ‘If to sey na morning wi dey!’ Dis na bikos, di kind tins wey una go dey si around una go make una dey fear. 68 Den God go put una for ship kon send una go back to Egypt, to di place wey E promise sey una nor go ever si again. Den for der, una go sell unasef give una enemies as slaves, but nobody go gri buy una.”