31
Joshua Lead Di Pipol
Den Moses tell Israel pipol dis word. “I don rish one hundred and twenty years naw and I nor go fit still bi una leader again. God don tell mi sey, ‘Yu nor go follow dem cross Jordan River.’ Na di Oga una God bi di Pesin wey go cross before una. E go distroy all di oda kountries for una and una go porshu dem komot. Oga God sey na Joshua go lead una cross Jordan River. God go ponish dis kountries just as E do to Amor pipol kings, Sihon and Og kon distroy dia land. God go put dem for una hand and na wetin I kommand una, una must do to dem. Make una dey strong and make una heart nor shake; make una nor fear dem at-all, bikos na di Oga una God dey go with una. E nor go leave or forget una.”
Den Moses koll Joshua kom out for all di pipol present kon sey, “Make yu dey strong and make yor heart nor shake, bikos na yu go lead dis pipol go di land wey God promise dia grand-grand papa and na yu go make dem get am. God go-go for yor front. E go dey with yu; E nor go leave or forget yu. Make fear nor katch yu and make di work nor taya yu.”
Dem Read Di Law
Moses rite all dis law kon gi-am to di priest, Levi shidren wey karry God Kovenant Box and e still give di law to all di eldas for Israel. 10 Moses kommand dem: “For di last day for evry seven years, for di rite time for di year wey dem dey kansol pipol debt, durin di time wey dem dey do Shelta First, 11 wen Israel pipol go kom before di Oga una God for di place wey E choose, yu must read dis law for dem make dem hear. 12 Make una gada all di pipol: men, wimen and shidren, plus all di strenjas among una, so dat dem go hear, learn and know how to fear di Oga una God kon obey all en law. 13 Den dia shidren wey know di law, go still hear, learn and fear di Oga una God as long as una dey di land wey una dey cross Jordan River go stay.”
Moses Bless Joshua
14 Den God tell Moses, “Di time wey yu go die don near well-well. Make yu koll Joshua kom di Tabanako, so dat I go fit tell am wetin e go do.” So Moses and Joshua go di Tabanako where di pipol gada put.
15 God appear to dem like kloud for di door-mot. 16 Den God tell Moses, “Yu go soon die, den di pipol go kon dey sin with strenj gods for di land where dem dey go. Dem go rijet mi kon break my kovenant wey I make with dem. 17 For dat time, I go vex for dem well-well kon leave and hide my face from dem until dia enemies kill dem finish. Many wahala and trobol go ovakom dem and dem go sey, ‘Dis wahala don finish us, bikos God no dey with us again.’ 18 But dat time, I go really hide my face, bikos of all di wikedness wey dem don do as dem dey serve oda gods.
19 “But make yu rite dis song for yorsef kon tish evribody for Israel. Make sure sey dem know am, so dat dis song go bi my witness against dem! 20 Bikos afta I don bring dem kom di land wey I promise dia grand-grand papa; di land wey get milk and honey; where dem go chop beleful kon get body, dem go turn go serve anoda god kon rijet and break my kovenant. 21 Den wen wahala and sofa fall for dia head, dis song go bi witness against dem, bikos dia shidren-shidren nor go forget am. I know wetin dem dey tink for dia mind today, even before I take dem go di land wey I promise dem.” 22 So for dat day, Moses rite di song kon tish evribody for Israel 23 and God kon make Joshua, Nun pikin leader for Israel sey, “Make yu dey strong and nor fear, bikos yu go take Israel, my pipol go di land wey I promise dem and I go dey with yu.”
To Disobey God
24 Wen Moses rite finish for dia present, 25 e kon kommand Levi pipol wey dey karry God Kovenant Box sey, 26 “Make una take di Law Book kon put am near di Oga una God Kovenant Box. E go dey der as witness against una, 27 bikos I know as una sturbon rish. True-true, as I stay among una kon rish today, una still dey disobey God; so how una sturbones go kon bi wen I don die? 28 Make all di tribes kom meet mi; una eldas and ofisas, so dat I go tok to dem by mysef about dis tins kon koll di heavens and eart to bi witness against dem. 29 Bikos I know sey wen I don die, una go spoil unasef kon turn from dis way wey I kommand una. Wahala go kom meet una dat time, bikos una don do bad tins wey go make God vex.”
30 Den Moses sing di words for di song from biginnin go rish di end, so dat evribody wey dey Israel, go hear am.