10
Old And New Sakrifice
Moses Law bi like shadow wey dey show good tins wey dey kom. Di shadow nor bi di tins, bikos di sakrifice wey dem dey offa evry year nor fit forgive pipol dia sins. If pipol wey dey woship God don free from dia sins, dem nor for dey offa sakrifice again. Doz sakrifice dey remind pipol of dia sins evry year, since melu and goat blood nor fit really klean pesin from all en sins. So wen Christ one kom dis world, e tell God:
“Nor bi sakrifice and ofrin yu wont,
bikos yu don prepare my body as ofrin,
since yu nor like animal blood
as ofrin for sins again.
Den I sey, ‘Na mi bi dis,
God na wetin yu wont I kom do,
just as yor word tok about mi for Moses Law.’ ”
Christ first sey, “Yu nor wont animal or sin ofrin, (even wen dem dey offa am akordin to di law).” Den e tok again sey, “Na mi bi dis, God na wetin yu wont I kom do.” So God remove di first sakrifice, so dat E go fit bring di new one, wey bi Christ. 10 Bikos Jesus do wetin God wont, all of us don dey holy thru di sakrifice wey e use en body make for us. 11 Before-before, di priest dey serve evriday and dey offa di same sakrifice wey nor fit remove sin. 12 But naw, Christ offa only one sakrifice for sin wons and for all, den e kon go sidan for God rite hand, 13 where e dey wait until God go put en enemies under en leg. 14 Na with one sakrifice e take klean pipol from dia sins and dem don dey klean forever. 15 Di Holy Spirit dey bear witness about dis tins sey, 16 “Dis na di kovenant wey I go make with una and afta dat time, 17 e kon sey, ‘I nor go remember dia sins and sturbones again.’ ” 18 Wen God don forgive sins, e get any nid to offa sakrifice again?
Make Wi Near God
19 So my brodas and sistas, wi bilive sey wi go enter God Holy Temple thru Jesus Christ blood, 20 bikos e give us dis new life and e go take us pass di curtain wey bi en body. 21 And wi get one High Priest wey dey kare for God Temple. 22 So make wi draw near God with betta heart and strong faith, bikos God don wosh awa heart and body with klean wota. 23 So make wi whole di hope wey wi get strong well-well, bikos God wey promise us dey always keep en promise. 24 Make wi always dey tink of how wi go enkourage, love and do good for one anoda. 25 Make wi nor stop to dey meet and fellowship togeda, as some pipol dey do, but make wi enkourage one anoda more-more, since wi know sey, “Di Day wen Christ go kom,” don near.
26 If wi kontinue to sin afta God don show us di trut, e nor get any oda sakrifice wey go fit forgive us awa sins again. 27 But wetin wi go dey fear for na di Judgement Day wey dey kom and hell-fire wey go distroy doz wey bi God enemies. 28 Wen two or three pipol bi witness sey somebody rijet Moses Law, dem go kill-am without sey dem sorry for am. 29 If pipol wey nor dey obey Man Pikin; dey take di kovenant blood make yeye and dey curse di Spirit wey bring grace, na how dia own ponishment go big rish? 30 Bikos God sey, “I go revensh, I go pay dem back” and en word still sey, “God go judge en pipol.” 31 Na big wahala if pesin fall enter God ponishment!
32 But make una remember how tins bi with una before, how una dey sofa afta una don receive God lite, yet una nor allow di sofa shange una mind. 33 Dat time, some pipol curse and sofa una and for oda times, una dey help odas wey dey sofa like una too. 34 True-true, una sofa like oda prisonas and una dey happy wen dem seize all una propaty, bikos una know sey una get betta tin wey go last forever. 35 So make una always dey strong, bikos una go get betta reward. 36 Una nid to dey patient, so dat una go fit do wetin God wont and den, una go receive en promise. 37 Bikos God word sey: “E nor go tey again before di Pesin wey dey plan to kom, go kom. 38 My raitious pipol go live and bilive, but if anybody turn back, I nor go dey happy with am.” 39 Wi nor dey among pipol wey go turn back kon perish, but wi get faith wey go save us forever.