2
Satan Test Job Again
For anoda day, wen God angels gada before God again, Satan sef follow dem kom too. God kon ask am, “Where yu from dey kom?”
Satan ansa, “I just dey waka anyhow for di world.”
God ask Satan, “Yu know my pikin wey dem dey koll Job? Nobody bi like am for dis eart; e dey klean and good well-well. E dey do wetin God wont and e nor dey do bad tins. Yu beg mi make I let yu attack am wen e nor do anytin, but e still dey fear mi as before.”
Satan ansa, “Di true bi sey, pesin go give Yu evritin wey e get, so dat e nor go die. Make Yu allow mi wound en body, den e go curse Yu for yor face!”
God kon tell Satan, “Evritin dey for yor hand, but make yu nor kill-am.”
So Satan live where God dey kon pak sore full Job body. Job sidan outside near dirty kon use breaki-breaki pot take dey skrape en sore.
En wife kon tell am, “Yu still dey respet dis God? Just curse am make yu die!”
10 But Job tell en wife, “Wetin make yu dey tok anyhow! Wen God give us good tins, wi take am. So naw wey trobol dey, make wi kon curse am?”
Even as all dis tins dey happen so, Job nor sin or curse God.
Job Friends Kom
11 Job three friends hear wetin dey happen to am, so dem kon sey dem go-go greet am. Dia names na Elifaz from Teman, Bildad from Shuh and Zofar from Naamah. 12 As dem kom, dem si Job from far, but dem nor sey na-im. Wen dem si sey na en, dem kon start to kry; dem tear dia klot kon pak san full dia head. 13 Dem sidan with am for seven days and seven nite. Nobody fit tok, bikos dem si as en kondishon bi.