26
Job Ansa Bildad
Job ansa:
“Si how yu don help pipol wey nor get pawa.
Yu don save pipol wey nor get strent at-all!
Yu dey give dem good advise kon share wetin yu know with fools,
like mi!
Who yu feel sey go hear all wetin yu dey tok?
Na wish spirit make yu dey tok like dis?
God Great
“Dead body dey shake with fear for dia grave.
Evritin wey dey inside wota dey shake too.
Where dead body dey stay just dey open before God;
nor-tin fit kover am from en eye.
God spread di sky for nort
kon hang di eart for empty space.
Na God put wota for di kloud
and E nor dey let rain fall from di kloud with force.
Na-im use di kloud
take kover di moon.
10 E kreate di sky wen E separate di wota
and divide lite from darkness.
11 As God tok, di pila wey hold di sky
kon dey shake with fear.
12 Na en pawa E use take silent di sea.
Na en wisdom E take distroy Rahab wey bi di wota juju.
13 Wen E breath, di sky dey klear.
Na en hand E take distroy di big snake.
14 But all dis na small tin kompare to di pawa wey E get.
Na small wi don hear.
Who go fit really undastand how God strong and great rish?”