29
Job Still Dey Tok
Job still sey:
“If to sey my life go fit bi as e bi before
wen God dey look and guide mi!
Dat time, God always dey with mi
and E dey give mi lite wen I dey waka for darkness.
Dat na di time wey evritin still dey well with mi.
Den God goodness still dey protet my house.
Den God still dey with mi
and all my shidren gada round mi.
My melu and goats dey give mi plenty milk
and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong.
Wen ever di town eldas dey meet
and I go der,
yong boys dey stand as soon as dem si mi dey kom
and old pipol dey stand greet mi with respet.
Di leaders wey dey lead di pipol
go stop to tok.
10 Even di pesin wey dey important pass,
go shut up for mi.
Job Dey Good Well-well
11 “Evribody wey hear from mi, dey praiz mi.
Doz wey hear mi dey tok, go-go tok good about mi.
12 Wen poor pipol kry kom meet mi,
I dey help dem;
I dey help pikin wey nor get papa
and mama and doz wey nor get where to go.
13 Doz wey dey face wahala, dey praiz mi
and I dey protet and guide wimen wey dia husband don die.
14 I dey always do betta tin.
Evritin wey I do dey always dey good.
15 Na mi bi blind pipol eye
and doz wey nor fit waka,
na mi bi dia leg.
16 I bi like papa to poor pipol
and I dey setol matter even for doz wey I nor know.
17 I dey distroy wiked pipol pawa
kon release di pesin wey dem katch.
Job Get Mind
18 “Den I sey, I go get long life
kon die for my house without trobol.
19 I go bi like tree wey en rut get wota;
wey dew dey wet en branches.
20 Evribody go dey praiz mi
and my pawa nor go fail.
Job Good Karata
21 “Wen I dey advise pipol,
dem dey kwayet listin to wetin I dey tok
22 and dem nor dey get anytin to tok wen I don tok finish.
My word dey enter dia mind well.
23 Evribody dey welkom mi,
just as farmer dey welkom rain wey won fall.
24 I dey smile give dem wey nor bilive diasef again
and my betta face dey give dem hope.
25 I dey lead dem as king dey lead many pipol
kon konfort dem wen dem dey face trobol.