35
Elihu Tok Again
Elihu still sey:
“Job, e dey rite make yu dey sey yu
nor do any bad tin for God eye?
Or to ask God sey, ‘Wetin I go gain if I nor sin?
Any nid dey to live klean life?’
I go ansa yu
and all yor friends.
Make una si how di kloud high rish!
Make una look di sky well-well!
If yu sin, e nor give God any trobol.
Even if yu kontinue to dey sin,
e nor go shake am.
Even if yu dey good well-well, na God yu dey favor?
E nor get wetin God wont for yor hand.
Just as yor wikedness dey affect only pipol
wey dey do like yu,
na so too di good wey yu do,
go affect doz wey dey do good.
Bikos of di opreshon
wey pipol dey sofa from strong pipol,
dem dey kry for help.
10 But dem nor dey kry to God wey kreate dem;
wey dey give dem hope for darkness.
11 Dem nor dey turn to God wey make us get sense;
di One wey make us wise pass animals and birds.
12 Dem dey kry for help,
but God nor dey ansa dem,
bikos dem too proud and dem dey do bad tins.
13 E nor get nid for dem to kry;
bikos God nor dey si or hear dia kry.
14 Yu sey yu nor fit si God;
but make yu dey patient,
bikos yor matter dey en hand.
15 Yu sey, ‘Wen God vex,
E nor dey ponish pipol,
bikos E nor dey kare about di bad tins wey dem dey do.’
16 But Job! No nid for yu to dey tok,
bikos e klear sey yu
nor know wetin yu dey tok about.”