37
“My heart kom dey beat fast-fast
as I bigin tink of dis tins.
Make all of una listin to God vois.
Make una listin to di tonda wey dey
kom out from en mout.
Na-im send lite go cross di sky;
from one end go rish di oda end for di world.
Dat time, una go hear di vois well-well
kon si di brite tonda lite as e dey pass.
Wen God tok, e dey bi like tonda
and wonderful tins dey happen;
tins wey wi nor fit undastand.
Na-im dey kommand snow and heavy rain sey,
make dem dey fall for di eart.
Na only en fit stop di work wey wi dey do,
so dat wi go know how E strong rish.
Den animals go-go dia house
kon stay der.
Heavy rain dey kom from sout,
while strong kold breeze dey kom from nort.
10 Wen God breath, wota dey turn to block!
Di wota dey block finish!
11 E load di kloud with wota
and lite dey flash kom out
12 as di kloud dey go
where God sey make e go.
Di kloud dey do evritin wey God kommand for dis world.
13 God wey dey send rain kom wota di eart,
fit still send am kom ponish or favor us.
14 Job, make yu wait small kon listin;
konsida all di wonderful tins wey God don do,
15 den yu go know how God take dey give kommand
and how E take make di lite flash for di kloud.
16 Yu know how di kloud take hang for sky?
Dat na one tin wey God do wey dey sopraiz evribody.
17 Wen yu dey sweet well-well
bikos of di heat wey di sout wind dey bring,
18 yu fit help God bring di sky kom out kon make am strong
like iron wey dem polish?
19 Make yu tish us wetin wi go tell God,
bikos wi nor get anytin for mind to tok.
20 Make dem go tell God sey I won tok to am?
Pesin even fit tok wen e konfuse?
21 Naw, di lite for sky brite well-well
and wi nor fit look am,
bikos breeze don swip di eart klean.
22 Na golden lite wi dey si for di nort
and na glory kover us for God present.
23 Wi nor fit kom klose to God,
bikos en pawa big well-well!
E always dey rite and korrect as E dey deal with us.
24 No wonder evribody dey fear am
and E nor get anytin to do with pipol
wey feel sey dem wise.”