12
Jeftah And Efraim Pipol
Efraim pipol gada sojas kon cross Jordan River go Zafon. Dem send dis message go meet Jeftah, “Why yu nor koll us wen yu dey go fight Ammon pipol? Bikos of dat, wi go burn yu and yor house togeda!”
But Jeftah ansa, “I koll una wen di fight just start, but una nor gri kom join mi fight Ammon pipol! So, as I si sey una nor gri kom, I kon risk my life go fight dem without una and God give mi viktory ova dem. So why una won kom fight mi?”
Den Efraim pipol sey, “Una, Gilead pipol, nor bi slave una bi to Efraim and Manasseh pipol?” Bikos of dat, Jeftah gada all Jabesh-Gilead men kon go attack and win Efraim pipol. Jeftah seize di place where dem dey pass cross Jordan River and if anybody from Efraim won try cross go back, Gilead men go shalenge and ask am, “Yu bi Efraim pesin?” If di pesin say, “No, I nor kom from der,” dem go tell am make e sey, “Shibbolet.” If e kom from Efraim, e go sey, “Sibbolet,” bikos Efraim pipol nor fit koll dat word well. Den dem go take am go kill for Jordan River korna. Na 42,000 Efraim pipol dem kill for dat time.
Jeftah lead Israel for six years, before e die and dem beri am for one of di town for Gilead.
Peace Kon Dey Again
Afta Jeftah die, Ibzan wey kom from Betlehem kon rule Israel pipol. E get thirty sons and thirty dotas. E make en girls shidren marry men from outside en town and en boys shidren marry dia wife from anoda town too. Ibzan rule Israel pipol for seven years. 10 Wen e die, dem beri am for Betlehem.
11 Afta Ibzan die, Elon wey kom from Zebulun tribe kon rule Israel for ten years. 12 Wen e die, dem beri am for Aijalon for Zebulun.
13 Afta Elon die, Abdon wey bi Hillel pikin, wey kom from Piraton kon rule Israel pipol. 14 E get forty sons and thirty grand-shidren wey dey ride seventy donkey. E rule Israel pipol for eight years. 15 So wen e die, dem beri am for Piraton for Efraim, for Amalek pipol hill kountry.