2
God Messenja For Bochim
God angel komot from Gilgal go Bokim kon tell Israel pipol, “Na mi bring una kom out from Egypt kon put una for dis land wey I promise to give una grand-grand papa and I tok sey I nor go break my promise with una. I sey make una nor make kovenant with di pipol wey dey dis land and make una distroy dia altar, but una nor do wetin I tell una. ‘Wetin make una do like dis?’ For dat time, I tell una sey, if una disobey mi, I nor go drive di pipol wey dey stay for una land komot again. Dem go bi wahala to una and dia god go dey sweet una to serve.”
Wen God angel don tok to Israel pipol finish, all of dem kon dey kry. So dem koll di place Bokim (wey mean “Cry”) kon offa sakrifice give God.
How Joshua Take Die
Afta Joshua don sey make di pipol dey go, each tribe komot go take di land wey dem divide for dem. So thru-out Joshua time, Israel pipol serve God and even afta e don die, dem still kontinue to dey serve am, since di leaders wey si all di good-good tins wey God do for dem still dey alive.
Joshua wey bi Nun pikin, God savant, die wen e bi one hundred and ten years. Dem beri am for en land wey dey Timnat-Heres, for Efraim hill kountry, near di nort side for Mount Gaash.
Israel Pipol Sin
10 Afta dat generashon die finish, di next generashon forget God and evritin wey E don do for dem. 11 Israel pipol sin against God and dem kon start to serve one juju wey dem dey koll Baal. 12 Dem forget di Oga wey bi dia grand-grand papa God wey bring dem kom out from Egypt kon bigin follow and woship di pipol wey dey around dem, gods. 13 Dem forget God kon dey serve Baal and Ashtoret image. 14 Bikos of dis, God vex well-well for dem, so E let tif karry all wetin dem get. E allow dia enemies opress dem and dem nor fit protet demsef again. 15 Anytime wen Israel pipol go fight war, God dey-dey against dem, just as God tok before and dem sofa well-well.
16 Den God give Israel pipol leaders wey kom save dem from dia enemies hand. 17 But dem nor still listin to di leaders, instead dem still dey serve and woship oda gods and dem nor do like dia grand-grand papa wey obey all God kommand. 18 As long as di leaders wey God give di pipol dey alive, E help and diliver dem from dia enemies. God sorry for dem well-well wen dem kry to am with pain, bikos of wetin dia enemies dey do dem. 19 But anytime di leaders die, dem go-go kontinue di bad-bad tins wey dem dey do. Dia own kon even worse pass di ones wey dia grand-grand papa do. Dem follow oda gods; dey serve and woship dem; dem nor gri stop dia sturbones and dem still dey do bad-bad tins.
20 So, God vex well-well for dem kon sey, “Bikos dis pipol don break my kovenant wey I make with dia grand-grand papa and forget my kommand, 21 I nor go drive any of di nashon wey Joshua nor fit win before e die. 22 I go use am take test dem weda dem go follow mi, just as dia grand-grand papa do.” 23 Na dis make God leave di nashons for der. E nor drive dem komot or allow Joshua win all of dem.