8
Den Efraim men tell Gideon, “Why yu do us like dis? Wen yu dey go fight Midian pipol, why yu nor koll us?” Dem kon dey komplain about am.
But e tell dem, “Make una nor vex! Even doh una nor kwik kom, wetin una do still big pass di ones wey mi and my men do. E just bi like wen dem harvest grape: di grape wey Efraim tribe waka leave for groun, betta pass all di ones wey Abiezer harvest! Si, na una use God pawa take kill Midian pipol two shief, wey bi Oreb and Zeeb. Wetin I do wey rish dat one?” Wen e tok like dis finish, di pipol kon stop to vex.
Gideon Katch Midian King
For dis time, Gideon and en three hundred men don cross Jordan River. Dem don taya, but dem still dey porshu dia enemies. Wen dem rish Sukkot, Gideon tell di men for di town sey, “Abeg, make una give my men some bread make dem chop, dem don taya and I dey porshu Zebah and Zalmunna wey bi Midian pipol kings.”
But Sukkot leaders ansa, “Why yu wont make wi give yor men food wen una neva katch Zebah and Zalmunna.”
So Gideon ansa, “Okay no problem! By di time wey God go put dem for my hand, I go flog una with kane and shuku-shuku wey I plok from desert!”
So Gideon go Penuel go meet di pipol wey dey der kon beg dem for di same tin, but dem ansa am, just like Sukkot leaders. E tell dem, make una nor worry, “I dey go, I go kom back alive and nor-tin go do mi. And by di time wey I kom back, I go distroy una towa!”
10 By dat time, Zebah and Zalmunna and dia soja, dey Karkor. Dem bi only 15,000 wey remain from all di men wey dey di desert tribe and dem don kill 120,000 of dia soja. 11 Gideon pass di road wey dey di desert korna for di east side for Nobah and Jogbehah kon go attack di sojas for der. 12 Di two Midian king wey bi Zebah and Zalmunna run komot, but e porshu and katch dem and dis tin kon make all di sojas sopraiz.
13 Wen Gideon dey kom back from di war, e kon pass thru Heres Pass and 14 e katch one man from Sukkot kon ask am kweshon, den di man rite di 77 leaders name for Sukkot, give Gideon. 15 Den Gideon go meet Sukkot men kon tell dem, “Una remember di time wen una sey una nor go fit help mi? Una sey una nor go fit give my sojas wey don taya food to chop, bikos I neva katch Zebah and Zalmunna. Naw, make una si dem!” 16 So e take kane and shuku-shuku from di desert kon flog Sukkot leaders. 17 E still distroy Penuel towa kon kill di men wey dey di town.
18 Den, Gideon ask Zebah and Zalmunna, “Di men wey una kill for Tabor, make una tell mi how dem bi!” Dem ansa, “Dem bi like yu, all of dem bi like king pikin.” 19 So Gideon sey, “Dem bi my brodas, my mama shidren. If to sey una nor kill dem, I swear I nor for kill una.” 20 Den e tell en senior pikin Jeta, “I kommand yu make yu kill dem!” But di pikin nor gri bring out en swod, e dey fear, bikos e still bi small boy.
21 So Zebah and Zalmunna kon tell Gideon, “Make yu kill us yorsef, bikos yu nid to get heart like man first, before yu go fit do wetin man dey do.” So Gideon kill dem kon take di gold wey dey dia kamel neck.
Gideon Rijet Crown
22 Leta, Israel pipol tell Gideon, “Make yu bi awa ruler, yu and yor shidren-shidren, bikos yu don save us from Midian pipol hand.”
23 But Gideon ansa, “I nor go fit bi una ruler, even my pikin nor fit. Na God go bi una ruler.” 24 And e still sey, “Make I beg una for one tin. Make all of una give mi di ear-ring wey una take from Midian pipol.” (dis na bikos, Midian pipol and oda desert pipol, dey wear gold ear-ring.)
25 Di pipol ansa, “Wi go dey happy to give yu.” So dem put klot for groun and evribody kon put di ear-ring wey dem take. 26 Di gold ear-ring wey Gideon kollect, heavy rish 20 kilogram and dis ones nor join di fine-fine gold, necklaces and di purpol klot wey Midian king dem dey wear and di kollar wey dey round dia kamel neck. 27 So Gideon make image with di gold kon put am for Ofrah wey bi en own town. Israel pipol forget God kon go der dey go woship di image. And e kon turn wahala for Gideon and en family.
Gideon die
28 So Israel pipol win Midian pipol and dem nor kon dey fear dem again. Di land kon get peace for forty years until Gideon die. 29 Gideon go back to en own town kon stay der. 30 E get 70 sons, bikos e marry many wife. 31 E still get one girl-friend for Shekem wey born one pikin for am and e kon koll am, Abimelek. 32 Gideon, Joash pikin, old well-well before e die and dem beri am for en papa Joash grave, for Ofrah wey dey Abiezer town.
Israel Pipol Go Serve Baal Again
33 Afta Gideon don die, Israel pipol kon dey sin against God, bikos dem dey woship Baal. 34 So dem nor kon dey serve and woship di Oga God wey save dem from all dia enemies wey dey around dem. 35 Even with all di good tins wey Gideon do for Israel pipol, dem still dey trit en family anyhow.