15
Di Vine And En Branches
“Na mi bi di korrect vine and na my Papa bi di gardina. E dey kut evry branches wey nor dey bear fruit for my body komot and e dey ripair evry branch for my body wey dey bear fruit, so dat e go bear more fruit. Una dey klean already, bikos of di word wey I tell una. Make una dey inside mi, so dat I go dey inside una too. As di branches nor fit bear fruit with en own pawa unless e dey inside di vine, na so una nor go fit bear fruit, unless una dey inside mi.
“Na mi bi di vine and na una bi di branches dem. Di pesin wey stay inside mi and I stay inside am, go bear plenty fruit, bikos without mi, una nor go fit do anytin. Anybody wey nor stay inside mi, go dry and pipol go gada en branches dem, trow and burn dem inside fire. If una stay inside mi and my word dey inside una, anytin wey una ask, I go do am for una. My Papa go get big honor if una bear plenty fruit, wey go show sey una bi my disciples.
“As my Papa love mi, na so I love una too, so make una live di kind life wey go let mi fit love una more-more. 10 If una do wetin I tok, I go love una, just as I dey obey wetin my Papa tok and E love mi. 11 I don tell una all dis tins, so dat my joy go dey inside una and una joy go full well-well. 12 Dis na di kommand wey I give una sey, ‘Make una love each oda di way I love una.’ 13 E nor get love wey big rish di one wey make pesin die for en friend. 14 Una go bi my friend if una do wetin I tok. 15 I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa. 16 Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name. 17 Wetin I dey tell una bi sey, ‘Make una love each oda.’ ”
Pipol Hate Jesus And En Disciples
18 “If pipol for dis world hate una, make una remember sey na mi dem first hate. 19 If una bi friend with di pipol for dis world, dem go love una as dia own pipol. But una nor bi dia friend, bikos I don choose una from di world, naim make dem nor like una. 20 Make una remember wetin I tell una, ‘Savant nor dey big pass en oga.’ If dem sofa mi, den dem go sofa una too. If to sey dem obey my word, dem go obey una own too. 21 Since dem nor know di Pesin wey send mi kom, dem go do all dis tins to una bikos of my name. 22 If to sey I nor kom tok to dem, dem for nor dey guilty for dia sin. But naw, dem nor get any eskuse for dia sin. 23 Di pesin wey hate mi, hate my Papa too. 24 If to sey dem nor si di mirakle wey I do, wey nobody don do before, dem for nor dey guilty for dia sin. But afta dem don si di mirakles, dem still hate mi and my Papa. 25 All dis tins happen, so dat wetin God law tok, go bi true sey, ‘Dem nor get rizin to take hate mi.’
26 “But wen di true Spirit wey I go send from my Papa to help una don kom, e go tok about mi. 27 And unasef go tok about mi, bikos una dey with mi from di biginnin.”