18
Judas Sell Jesus
Afta e don tok finish, Jesus and en disciples komot cross go Kidron Valley kon enter one big farm.
(Judas, wey sell Jesus, know di place, bikos Jesus don go der with en disciples many times). So Judas kon escort many soja, some Temple polise and Farisee pipol enter di farm. Dem whole lamp, tosh and some whole swod and stik for hand.
Bikos Jesus know evritin wey go happen to am, e kon ask dem, “Who una dey find?”
Dem ansa am, “Na Jesus wey kom from Nazaret.”
E kon tell dem, “Na mi bi di pesin.” (Judas wey sell am, stand der with dem). So wen Jesus don tell dem sey, “Na mi bi di pesin”, dem dress go back kon fall for groun.
Den Jesus ask dem again, “Who una sey una dey find?”
Dem ansa, “Na Jesus wey kom from Nazaret.” Jesus kon sey, “I don tell una sey na mi bi di pesin. Since na mi una dey find, make una allow dis men go.” (E tok dis word make e bi sey wetin dem rite for God word na true, “I nor lost anybody among di sheep wey yu give mi.”)
10 Den Simon Pita bring en swod out kon kut di High Priest savant rite ear komot. (Di savant name na Malkus).
11 Jesus kon tell Pita, “Make yu put yor swod back for where e dey before! Yu nor know sey I go drink from di sofa cup wey my Papa give mi?”
12 Den di sojas with dia oga and di Jew oga dem take Jesus kon tie am with rope. 13 Dem take am go meet Annas, Kaiafas fada-in-law, wey bi di High Priest for dat year. 14 (Dis na di Kaiafas wey advise di Jew oga dem sey, “E good make one man die for evribody”).
Di First Time Wey Pita Deny Jesus
15 Simon Pita with anoda disciple kon follow dem as dem dey take Jesus go meet Annas. (Di oda disciples know di High Priest well-well, so e follow Jesus enter inside di High Priest kompond). 16 But Simon Pita stand outside di kompond near di door. Den di oda disciple wey know di High Priest kom out kon tok to di savant girl wey dey guide di gate and e kon allow Pita enter inside.
17 Di girl wey dey di gate kon ask Pita, “Yu nor bi one of dis man disciple?”
At wons, Pita ansa, “I nor bi one of dem.”
18 For dis time, all di savant and guards gada round shako fire wey dem make to warm demsef, bikos kold strong well-well. Pita follow dem stand der dey warm ensef too.
Annas Ask Jesus Kweshon
19 As dem dey der, di High Priest bigin dey ask Jesus kweshon about en disciples and wetin e tish.
20 Jesus kon ansa am, “Na for publik I tok wetin I tish. Na inside sinagog and Temple where all di Jew pipol dey gada, na der I for dey tish. I nor tok anytin for sekret. 21 Why yu dey ask mi? Make yu ask di pipol wey hear mi. Dem know wetin I tok.”
22 Afta Jesus don tok finish, one of di High Priest savant, wey stand near am slap am for face kon ask am, “Na di High Priest yu dey tok to like dis?”
23 Den Jesus sey, “If wetin I tok nor korrect, make yu tell mi, but if e korrect, why yu slap mi?” 24 Den Annas kon send am as dem still tie am with rope, go meet Kaiafas, wey bi di High Priest.
Pita Deny Jesus Again
25 As Simon Pita stand for inside di kompond dey warm ensef, dem kon ask am, “Yu too nor bi one of en disciple?”
Pita deny sey, “I nor dey among dem.”
26 One High Priest savant, wey bi di same family with di man wey Pita take swod kut en ear kon sey, “I nor si yu with am for inside di farm?” 27 Pita deny again for dia front and fawol kon do “Kukuruku.”
Jesus Stand For Pilate Front
28 Den, dem take Jesus komot from Kaiafas place go di Roman Govnor palis. (By dis time, morning don rish). Dem nor gri enter inside di govnor house, make dem nor for dirty as dia tradishon tok, so dat dem go fit chop di Passova food. 29 So Pilate kom meet dem for outside kon ask dem, “Wetin una sey dis man do?”
30 Dem ansa, “If to sey dis man nor bi criminal, wi nor for bring am kom meet yu.”
31 Den Pilate tell dem, “Make una go judge am as una law tok.”
Di Jew oga dem kon sey, “Awa law nor give us pawa to kill anybody.” 32 (Dis tin happen to show sey wetin Jesus tok about how e go die, na true).
Pilate Ask Jesus Kweshon
33 So Pilate go inside en house for di palis, kon koll Jesus ask am, “Na yu bi di Jew pipol king?”
34 Jesus ansa am, “Na from yor mind yu ask dis kweshon, abi pipol don tell yu about mi?”
35 Pilate kon sey, “Yu know sey I nor bi Jew, abi? Na yor pipol and priest oga dem bring yu kom meet mi. Wetin yu do sef?”
36 Jesus ansa, “My kingdom nor dey dis world. If to sey my kingdom dey dis world, my savants for fight make I nor kom meet di Jew oga dem. But as e bi so, my kingdom nor dey here.”
37 Den Pilate ask am, “So yu bi king?”
Jesus ansa, “Na yu tok so and yu dey korrect sey, I bi king. Na dis make dem born mi and naim make mi kom dis world kon tok di trut. Anybody wey wont hear di trut, go listin to wetin I dey tok.”
38 Pilate still ask am, “Wetin bi di trut?” Den e go outside again go meet di Jew oga dem kon tell dem, “I nor si any bad tin wey dis man do o-o. 39 But as una custom sey make I free one prisona for una for Passova, una wont make I free Jesus, wey bi di Jew king?”
40 Den, dem kon dey shaut, “Wi nor wont dat man, na Barabas wi wont and na criminal dis Barabas bi.”