3
Jesus Tok With Nikodimos
E get one man wey bi Farisee, en name na Nikodimos and e bi memba for di kansol wey dey rule Jew pipol. E hide go meet Jesus for nite kon tell am, “Tisha, wi know sey yu bi di pesin wey God send kom meet us, bikos nobody fit do di mirakles wey yu dey do, unless God dey with am.” Jesus tell am, “Make I tell yu true word, unless dem born pesin di sekond time, e nor go fit si God kingdom.”
Den Nikodimos ask am, “How dem go fit take born pesin wey don old for di sekond time? Abi di pesin go enter en mama belle make di mama born am again? E fit happen like dat?”
Jesus ansa am, “I tell yu di trut, unless God born pesin with wota and en Spirit, di pesin nor go fit enter God kingdom. Wetin flesh born, na flesh e bi, but wetin God Spirit born, na spirit e bi. So, make yu nor konfuse bikos I tok sey, ‘God go born yu for di sekond time.’ Wen breeze dey blow, e dey go anywhere e wont, yu dey hear di sound wey e dey make, but yu nor fit know where e dey kom from or where e dey go. Na so e bi with evribody wey God Spirit born.”
Nikodimos kon ask am, “How dis tins go fit happen?”
10 Jesus ansa, “Yu bi tisha for Israel, yet yu nor fit undastand dis tins? 11 Make I tell yu di trut, wi dey tok wetin wi sabi and dey bear witness for wetin wi don si with awa eyes, but una nor gri asept wetin wi tok. 12 Naw, if I dey tell una about di tins wey dey for dis world and una nor fit bilive wetin I tok, how una go fit take bilive mi, if I bigin dey tell una about di tins wey dey for heaven? 13 Nobody don go heaven before, escept Man Pikin wey kom down from heaven and e go-go back der. 14 Yu si, as Moses karry di snake go up wen dem dey inside desert, na so too dem go karry Man Pikin up, 15 so dat anybody wey bilive am, go get life wey nor dey end.
16 “God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end. 17 God nor send en pikin kom kondemn di pipol wey dey inside di world, but make e kom save dem. 18 Anybody wey bilive am, God nor go kondemn am. But di pesin wey nor bilive am, God don kondemn am already, bikos di pesin nor bilive God Pikin name. 19 Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good. 20 Yu si, evribody wey dey do bad tins dey hate lite and dem nor go gri kom out for where lite dey, make pipol nor for si di bad tins wey dem dey do. 21 But di pesin wey dey do good tins, dey kom out for lite, so dat pipol go si di tins wey e dey do, bikos na as God wont naim e dey do.”
John Di Baptist Tok About Jesus
22 Leta, Jesus and en disciples go Judea aria and dem kon stay der for sometaim dey baptize pipol. 23 John dey baptize for Aenon, one town wey near Salim, bikos plenty wota dey der and pipol dey kom meet am make e baptize dem. 24 (For dis time, dem neva put John for prison). 25 Den one Jew man kon dey argue with John disciples about how dem suppose to wosh dia body as dia tradishon tok. 26 Some among dem go meet John kon tell am, “Oga God, di pesin wey dey with yu for di oda side for Jordan River, wey yu tok about before, en too, dey baptize pipol and evribody dey rush go meet am.”
27 John ansa dem, “Nobody go fit get anytin unless God wey dey heaven, gi-am. 28 Unasef go fit bear witness sey, I tok sey I nor bi di Christ, but God send mi kom, before Christ go kom. 29 Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full. 30 Pipol must know Christ pass as dem know mi.
31 “Di pesin wey kom from heaven betta pass evribody wey dey for dis world. And who dey dis world, dey tok about di tins wey dey inside di world. 32 But di pesin wey kom from heaven dey tok about wetin e si and hear for heaven, but pipol nor gri listin to am. 33 But pesin wey bilive wetin e tok about God, bilive sey wetin God tok, na true. 34 Di pesin wey God send dey tok about God word, bikos God dey give en Spirit to pipol. 35 God love en pikin well-well and E gi-am pawa to kontrol evritin. 36 Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”