15
Wahala For Judah Pipol
Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go! If dem ask yu, ‘Where wi won go?’ Tell dem sey, ‘God sey:
“ ‘ “Pipol wey dem don sey, na diziz go kill,
na diziz go really kill dem.
Doz wey dem sey go die for war,
go really die for war.
Doz wey dem sey na honga go kill,
na honga go kill dem
and doz wey dem sey dem go katch go as slave,
dem go katch dem go.” ’
“ ‘Mi, wey bi God sey, “I go ponish dem for four difren ways: I go make dem die for war. I go allow dog karry dia dead body. I go allow birds and wiked animals chop dia flesh and I go make all di pipol for di world dey fear, bikos of wetin happen. Dem go fear, bikos of wetin Judah king, Hezekaya wey Manasseh born, do for Jerusalem.” ’ ”
God sey,
“Jerusalem pipol, who go sorry and pity for una?
Who go stop kon ask, how una dey?
Una don rijet and turn from mi
and na dis make mi vex
kon bring wahala for una.
I don taya to dey sorry for una.”
God still sey,
“Just as breeze dey blow and skata dirty for evriwhere,
na so too I go skata una for evriwhere for di eart.
I go distroy una wey bi my pipol
kon kill una shidren,
bikos una nor gri stop di bad-bad tins
wey una dey do.
Wimen wey dia husband go die,
go plenty pass san-san wey dey near wotaside.
I go kill una yong men for aftanoon
kon make dia mama sofa.
Na mi make dem dey sofa
and fear go katch dem well-well.
Di woman wey bin get seven shidren, go faint.
E nor go fit breath well again.
Naw wey e suppose to dey enjoy life,
dem don take en pride and joy from am.
E go bi like sey evening don rish
even doh sun still dey shine well-well.
Na shame and disgrace go follow am.
And any of dem wey still dey alive,
I go make dia enemies kill dem for war.”
Mi, wey bi God, don tok.
Jeremaya Komplain Give God
10 I kon sey,
“Si as I dey vex!
Wetin make my mama born mi at-all?
Must I kworel and argue with evribody for di land!
I neva ever borrow from pesin or borrow pesin money,
yet evribody dey curse mi.”
11 God ansa,
“I go diliver and save Jerusalem from evry attack
even doh I allow dia enemies karry dem go,
so dat dem go learn.
But wen una enemies dey trobol,
dem go run kom meet una sey make una help dem.
12 Una wey bi like iron and bronze,
una fit break di iron wey dey nort?
13 I go send enemies kom tif una propaty
and dis go bi ponishment for di sins
wey una kommit for di land.
14 I go make una serve una enemies for strenj land,
bikos my vexnashon bi like fire
and e go burn forever.”
15 Den I ansa,
“My God! Yu know as I dey sofa.
Abeg make Yu remember kon help mi.
Make Yu revensh
doz wey dey tok bad against mi.
Nor sorry for dem,
so dat dem nor go kill mi.
Make Yu remember sey na bikos of Yu,
dem dey curse mi.
16 My Oga God wey dey mighty,
anytime Yu dey tok to mi,
I dey listin well-well
and na joy and happiness full my heart,
bikos I bi yor own.
17 I nor dey spend my time to play
and enjoy mysef with oda pipol.
I dey always dey alone;
dey obey yor word
and I dey vex for evil pipol,
bikos of wetin dem don do.
18 So, wetin make mi still dey sofa?
Why I go dey bear dia curse like sore wey nor get cure?
Yu dey plan to leave mi
like stream wey dry?”
19 Bikos of dis, God kon sey,
“If yu turn from sin kom meet God
kon stop wetin yu dey tok and tink,
I go take yu back
and yu go bi my savant again.
If yu stop to tok anyhow,
yu go bi my profet again.
Den di pipol go won bi like yu
and yu nor go bi like dem.
20 Bikos of dem,
I go make yu bi like strong wall.
Dem go fight yu,
but dem nor go fit win.
I dey with yu;
I go protet and save yu.
21 I go save yu from wiked pipol
and doz wey like trobol.”
Mi, wey bi God, don tok.