49
God Judge Ammon Town
Dis na wetin God tok about Ammon pipol:
“Una tink sey nobody remain for Israel again?
Abi una feel sey dem nor dey again
so nobody go kollect dia land back?
Na dis make una dey woship Molek
bikos una don take-ova Gad land kon dey stay der?
But di time dey kom wen I go make Rabbah pipol hear war nois,
den dem go distroy and burn dia village rish groun.
Den Israel pipol go take dia land back
from doz wey take am from dem.
Heshbon pipol, make una kry,
bikos dem don distroy Ai! Rabbah wimen,
make una wear sak klot kon mourn.
Make una dey konfuse,
bikos dem go karry una god, Molek
with en priests and princess, go anoda kountry.
Ammon pipol! Why una nor dey faithful and dey boast?
Wetin make una dey bilive sey una money go save una
kon dey ask, ‘Na who go try to attack us?’
I go make fear katch una from evriwhere
and all of una go run.
Evribody go run for dia life
and nobody go gada una wey remain again.
But afta, I go make Ammon prosper again.
Mi, wey bi God, don tok.”
God Judge Edom Land
Dis na wetin God wey mighty tok about Edom:
“Teman pipol nor sabi judge well again?
Who dey advise Edom nor fit tell dem wetin dem go do?
Abi all dia sense and wisdom don vanish?
Dedan pipol, make una run go hide!
I go distroy Esau shidren-shidren,
bikos di time don rish for mi to ponish dem.
Wen pipol dey pick grape,
dem dey leave small for di vine
and wen tif kom tif for nite,
dem dey take only wetin dem wont.
10 But I don naked Esau shidren-shidren finish
kon open where dem hide put,
so dat dem nor go fit hide again.
Dem don distroy Edom pipol
and nobody among dem remain.
11 Shidren wey nor get papa and mama,
make yu leave dem for mi and I go kare for dem.
Wimen wey nor get husband,
make dem make dem kom meet mi and I go help dem.”
12 God still sey, “Even doz wey I nor suppose ponish, go drink from di ponishment cup. Abi una bin tink sey I nor go ponish una? No! Una must drink from dat cup! 13 I don swear sey Bozrah town go turn desert wey go dey make pipol fear; pipol go laf and use dem as curse. I go skata all di village wey dey around dem forever.
Mi, wey bi God, don tok.”
14 So I kon go meet and tell Edom pipol sey,
“I don receive message from God.
E don send messenja go tell all di nashons sey
make dem gada dia sojas
and make dem ready kon attack una.
15 God go make una weak among oda nashon
and nobody go respet una again.
16 Una pride don deceive una.
Nobody dey fear una as una tink.
Una dey stay for rock and on-top mountin a
nd even doh una house high like eagle own,
God go bring una kom down.”
Dis na wetin Oga God tok.
17 God sey,
“Di wahala wey dey kom meet Edom pipol go bad well-well
and wen pipol si am, dem go shok and fear go katch dem.
18 Na di same tin wey happen to Sodom and Gomorrah,
go happen to Edom pipol;
God go distroy dem and di village wey dey round dem.
Nobody go ever stay der again.
Mi, wey bi God, don tok.”
19 “Like lion wey run kom from Jordan bush
kon katch sheep for fine betta land,
na so too I go make Edom pipol run
komot from dia kountry.
Den di leaders wey I choose go rule di nashon.
Bikos e nor get anybody wey bi like mi
and nobody fit shalenge mi!
Wish ruler fit go against wetin I tok?
20 So make yu listin to di plan wey I get for Edom pipol
and wetin I won do to di pipol wey dey Teman town.
Dem go drag dia shidren go and I go distroy di land
finish bikos of di tins dem do.
21 Wen Edom fall, di nois go make di whole eart shake
and even as Akaba far rish, pipol go hear dia kry.
22 Enemies go attack Bozrah land
like eagle wey spread en feada.
For dat day, Edom sojas go dey fear
and shake like woman wey won born.”
Damaskus Judgement
23 Dis na wetin God tok about Damaskus:
“Di pipol for Hamat and Arpad town
dey worry and dem nor get rest,
bikos dem hear bad news.
Dia mind dey trobol dem like river
and dem nor fit rest.
24 Damaskus pipol don weak and dem kon run,
bikos dem dey fear.
Dem dey feel pain like woman wey won born.
25 Di town wey full with happiness before,
wey pipol know well-well, don empty finish.
26 For dat day, dem go kill all di yong men for di town
kon distroy dia sojas.
27 I go set fire for Damaskus wall
and e go burn King Ben-Hadad palis rish groun.
Mi, wey bi God wey dey mighty, don tok.”
Kedar And Hazor Town Judgement
28 Dis na wetin God tok about Kedar and Hazor kingdom, wey King Nebukadnezzar for Babilon, win:
“Make una katch Kedar pipol
kon distroy doz wey dey east!
29 Make una seize dia tent, animals, curtain and evritin wey dey der.
Make una take dia kamels, den tell di pipol sey,
‘Na fear go kill una!’
30 Hazor pipol, mi wey bi God dey warn una sey
‘Make una run go hide,
bikos King Nebukadnezzar don plan against una
and dis na wetin e tok,
31 “Kom, make wi go attack doz pipol wey dey save and sikure!
Dia town nor get gate or wetin dem take dey lock am,
so dem nor dey protet am.
32 So, I go take dia kamel and all dia animals!
I go skata pipol wey kut dia hair
kon bring wahala kom meet dem from evry side.
33 Hazor go turn desert forever
and na only jackals go dey stay der.
Nobody go ever stay der again.” ’
Mi, wey bi God, don tok.”
God go Judge Elam Pipol
34 Afta Zedekaya just bi king for Judah, God tok to mi about Elam town. 35 E sey,
“I go kill all di sojas
wey dey guide and protet Elam pipol.
36 I go make breeze blow against Elam from difren direcshon
kon skata en pipol go evriwhere,
until en pipol don run go hide for all di kountry
wey dey dis world.
37 I go make Elam pipol fear dia enemies.
Bikos I dey vex, I go distroy Elam pipol
kon send sojas go porshu dem
until I don kill all of dem finish.
38 I go distroy dia kings and leaders
kon build my throne for der.
39 But afta, I go make Elam pipol prosper again.
Mi, wey bi God, don tok.”