5
God sey, “Waka round Jerusalem street
kon shek for where pipol gada weda
una go si any good and raitious pesin.
If una si, I nor go ponish di town again.
Doh dis pipol dey swear with God name,
but di trut bi sey, dem nor mean wetin dem dey tok.”
My God, shebi na trut Yu wont?
But even wen Yu ponish dis pipol,
dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem,
dem nor gri take korreshon.
Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin
kom meet Yu make Yu for forgive dem.
So I kon sey, “Na only poor and foolish pipol dey bihave like dis.
Dem dey bihave like fools, bikos dem nor know wetin God wont.
Dem nor know wetin dia God wont make dem do.
I go-go meet and tok to di leaders,
bikos dem know wetin God wont and wetin E sey make dem do.”
But even dem too don rijet God and nor gri obey en kommand.
So just as lion dey attack oda animals for bush,
na so too dia enemies go attack dem
and just as wolf bi for desert,
na so too dem go distroy dem.
Na leopard go dey guide di town and if anybody won
kom out from di town,
dem go distroy am, bikos dia sin too many
and dem don turn from God.
God ask, “Jerusalem pipol!
Wetin nor go make mi ponish una wen e bi sey,
una leave mi kon go woship gods wey nor bi god at-all?
Even doh I dey give una evritin wey una wont,
una still dey bihave like wife wey go sleep with who
nor bi en husband and una dey stay with ashawo.
Una bi like horse wey dem feed well
wey still get long-trot;
each of una still dey find una neighbour wife
wey una go sleep with.
Naw, God sey, ‘I go really ponish dem for evritin wey dem do.
Yes! I go bring sorrow and pain kom dis nashon!’ ”
10 So God kommand di enemies sey,
“Make una go distroy di vines for Israel
and di vineyard for Judah,
but nor distroy dem finish.
Kut dia branches komot,
bikos doz branches nor bi God own.
11 Dis na bikos, Israel and Judah pipol
nor dey faithful to mi again.”
Mi, wey bi God, don tok.
12 Dem deny wetin God tok kon sey,
“God nor go do anytin!
No bad tin go fit happen to us;
wi nor go ever si war or honga till wi die.
13 All wetin di profets tok nor mean anytin.
God nor tok thru dem,
so make wetin dem tok, happen to dem.”
14 But Oga God wey dey rule all of us kon tell mi,
“Bikos dis pipol tok like dis,
I go make yor words bi like fire.
Den, I go make dis pipol bi like wood
and di fire go burn dem.”
15 God sey, “Israel pipol, make una listin!
I dey bring enemies kom from far kountry kon attack una.
Na kountry wey strong well-well; wey I kreate since;
kountry wey una nor know or undastand dia language.
16 Dia sojas get pawa well-well and dem
nor dey sorry for pesin wen dem won kill-am.
17 Dem go chop evritin wey una plant and una animals too;
dem nor go leave one fruit for una vine tree.
Even doh una tink sey una dey save inside una strong town,
dem go distroy di town kon kill una shidren.
18 But I nor go distroy una finish.”
Dis na wetin God tok.
19 So Jeremaya, anytime wey yor pipol ask,
“Wetin make di Oga God ponish us like dis?
Make yu ansa, ‘Na bikos dem leave God go woship oda gods
for dia land and bikos of dat,
una must go serve as slave for anoda land.’ ”
20 God sey, “Go tell Jakob shidren-shidren
and all Judah pipol sey:
21 Make una listin, ‘Una bi fool and una nor get sense.
Una get eye, but una nor dey si;
una get ear, but una nor dey hear.’ ”
22 God sey, “Una nor suppose fear mi wey bi God?
Why una nor dey shake with fear wen una si mi?
Na mi make san as boundary for sea and dis san
nor go let di sea flow pass where I sey make e flow rish.
Di wave fit karry di sea up-and-down,
but e nor go fit pass der.
Di wave fit make nois,
but dem nor go fit pass di boundary.
23 But dis pipol sturbon and get strong heart.
Dem don leave mi go dia own way.
24 Dem neva even tell diasef wons sey,
‘Make wi try fear di Oga wey bi awa God.
Bikos na-im dey send rain kom for harvest time.’
25 But, una sin don make mi stop to dey
give una all dis good tins.
26 Wiked men dey stay among my pipol,
dem dey wait like pipol wey dey spread net
to katch bird or set trap to katch pipol.
27 Just as hunta pak bird full kage,
na so dem pak money wey dem get thru wayo full dia house
and na dis make dem rish well-well kon get pawa.
28 Dem don fat and dey chop betta food.
Dem nor know wen to stop all di bad tins wey dem dey do.
Dem nor dey give doz wey nor get papa dia rite
or give betta judgement to doz wey dem dey opress.
29 So, I go really ponish dem for evritin wey dem do.
Yes! I go bring sorrow and pain kom dis nashon!”
30 Sirious tins wey go make pipol sopraiz and fear,
go happen for Judah:
31 Di profet dem dey lie;
di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat.
But di day wey wahala and distroshon go start,
na where dem go run go for help?