7
Jeremaya Prish For Di Temple
God tell Jeremaya: “Make yu stand for di temple gate kon shaut tok dis message: ‘Judah pipol wey dey pass thru dis gates kom woship God, make una listin! Make una hear wetin God won tok. Oga wey bi Israel God wey dey rule all of us sey, Make una shange from di kind life wey una dey live kon do di rite tin. If una shange, I go allow una stay for dis land.’ Make una nor bilive di lie wey make una dey sey, ‘Wi dey save, bikos God temple dey here! Yes! God temple dey here!’ Make una shange from di kind life wey una dey live kon dey do di rite tin. Make una respet each oda too. Make una stop to opress di strenjas among una; shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die. Make una stop to kill innocent pipol and woship oda gods, bikos e go distroy una. If una stop to do all dis tins, I go allow una stay for dis land wey I give una grand-grand papa as dia propaty.
“But make una si una life! Una dey bilive lie-lie words wey nor go save una. Una dey tif; kill; dey sleep with who una nor marry; dey lie; dey swear; dey offa sakrifice give juju and dey woship gods wey una nor know before. 10 Wen una don do all dis tins wey I hate finish, una go kom stand for my present inside my temple kon dey sey, ‘Wi dey save!’ Una tink sey una really dey save wen una dey do all di tins wey I hate? 11 God sey, Una tink sey my temple na where tif dey hide put? Make una know sey I don si wetin una dey do. 12 Make una go Shiloh, di place wey I first choose sey dem go for dey woship mi. Make una si wetin I do for der bikos of di wiked tins wey my pipol Israel, do. 13 Una don do all dis tins and even as I tok to una rish, una nor gri listin or ansa wen I koll una make una turn kom meet mi. 14 So, just as I distroy Shiloh, na so too I go distroy dis my temple wey una trust sey go protet una, even doh I bin gi-am to una and una grand-grand papa. 15 Just as I porshu Israel pipol wey bi una relashon, na so too, I go porshu una komot from my front.
Mi, Oga God, don tok.”
Di Pipol Nor Agri Obey
16 Den God tell mi, “Jeremaya! Make yu nor pray for dis pipol. Make yu nor kry or pray give mi bikos of dem! Nor beg make I save dem, bikos I nor go listin to yu. 17 Abi yu nor dey si all wetin dem dey do for Judah and for evry street for Jerusalem? 18 Dia shidren dey gada firewood; men dey make di fire and di wimen dey mix flower wey dem go take bake kake for dat juju wey dem dey koll, ‘Heaven Kween.’ Dem still dey pour wine give oda gods as ofrin and dis tin dey make mi vex. 19 Na mi, dem tink sey dem dey do? ‘No!’ Na demsef dem dey bring wahala and shame kom meet.”
20 So, di Oga God sey, “I go pour my vexnashon for dis land. I go pour am put for both pipol and animals body and even di trees and food wey dem plant. My vexnashon go burn like fire and nobody go fit kwensh am.”
21 God still tell Judah pipol, “Una fit still go put una burnt ofrin join di oda sakrifice kon chop all of dem! 22 Si, wen I bring una grand-grand papa dem kom out from Egypt kon tok to dem, I nor only kommand dem for wetin dem go do koncerning di burnt ofrin and sakrifice. 23 But I kommand dem sey, ‘Make una obey mi and if una obey mi, I go bi una God and una go bi my pipol. Make una live una life as I tell una and evritin go betta for una.’ 24 But dem nor gri listin or hear mi. Dem dey do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do. Instead make dem dey betta, dem kon worse pass as dem bi before. 25 Since una grand-grand papa kom out from Egypt kon rish naw, I dey always send my savants, di profets kom meet una. 26 But nobody among una dey listin or hear dem. Instead, una sturbon and wiked pass una grand-grand papa.”
27 Den God tell mi, “Even wen yu don tell dem all dis tins finish, dem nor go still listin to yu; yu go koll dem, but dem nor go ansa yu.”
28 So tell dem sey: “Dis na nashon wey nor gri obey di Oga dia God or learn from dia wahala. Nobody for der dey good and di pipol nor dey even tok about good tins again. 29 So, Jerusalem pipol! Make una mourn and kut una hair. Make una sing burial song on-top evry hill, bikos God sey, ‘I go rijet and forget dis pipol, bikos dem don make mi vex.’ ”
30 God sey, “I don rijet Judah pipol, bikos of di wiked tins wey dem do. Dia juju wey I hate, dem put am for my temple kon make di temple dirty. 31 And dem even build where dem go for dey woship for Tofet wey dey Ben-Hinnom Valley, so dat dem go fit sakrifice dia shidren give juju for der. Dis na wetin I sey make dem nor do! True-true, dat kind tin neva even enter my mind to tell dem. 32 So, di time dey kom wen dem nor go koll dat place, ‘Tofet or Hinnom Valley again’, but dem go koll am, ‘Valley where dem for dey kill pipol.’ Dem go beri pipol for der, bikos know oda place go dey to beri pipol put. 33 Den dis wiked pipol dead body go dey for groun and birds with wild animals go chop am. Nobody go remain for der to porshu di animals. 34 For Judah town and Jerusalem street, I go make sure sey nobody dey shaut or happy with joy sey pesin dey marry. Dis na bikos di whole land dey empty and dirty don full der.”