9
I wish sey my head bi like well wey wota full
and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out,
den I go kry well-well both day and nite
for my pipol wey dem kill.
I wish sey I get where I fit go stay for desert;
I for go, so dat my pipol nor go fit si mi,
bikos dem nor dey faithful to God.
Judgement For Sinnas
God sey,
“Dis pipol bi like sojas
wey don ready dia bows.
Dem always dey ready to lie,
bikos of dis, dem don get pawa for di land,
but na wayo dem take get am.
Dem don do many bad tins
and dem nor dey tink of mi wey bi dia God.
Make evribody dey kareful of en friends
and make yu nor trust yor broda,
bikos even broda dey shit en broda.
And friends dey lie against each oda well-well.
Friends dey deceive friends
and nobody dey tok trut.
Dem don train demsef to dey lie
and do bad tins.
Dem nor gri turn from sin
kom meet God.
Just as dem dey do one wiked tin finish,
na so dem dey start anoda one.
Dis pipol nor gri listin to mi wey bi God.”
So God wey dey rule evritin kon sey,
“Like iron, na so too I go melt
and test my pipol for fire,
bikos dem don do wiked tins well-well.
Abi na how I won do dem pass?
Dia mout sharp like arrow
and na so-so lie full am.
Dem dey tok well with dia neighbours,
but for dia mind,
na trap dem dey set for di pesin.
Make I nor ponish dem for all dis tins wey dem do?
Abi make I nor distroy nashon wey bi like dis?”
Mi, wey bi God, don tok.
10 So I kon sey,
“I go kry and mourn for di grass wey dey on-top mountin,
bikos dem don dry and nobody dey travel pass der again.
Dem nor dey hear fawol nois for der again
and even bird and wild animals, don fly komot der.”
11 God sey,
“I go pak dirty full Jerusalem and jackals go dey stay der,
den I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.”
12 So I ask,
“Na who wise rish to undastand
wetin make dis tins happen?
Na who God don tell wey fit esplain
why e bi like dis?
Wetin make di land skata kon dry like desert
wey pipol nor fit travel pass?”
13 God ansa,
“Dis tins happen,
bikos my pipol rijet di law wey I give dem.
Dem nor gri obey
or do wetin I sey make dem do.
14 Instead, dem get strong heart
kon dey woship Baal,
just as dia grand-grand papa tish dem.
15 So, make yu listin to wetin mi,
Israel God wey get pawa go do:
‘I go make dis pipol chop bitter food
kon make dem drink di judgement wota wey get poizin.
16 I go skata dem go difren nashons wey dem
or dia grand-grand papa neva hear of before
kon send sojas go fight dem,
until I don distroy dem finish.’ ”
Jerusalem Pipol Cry For Help
17 God wey dey rule evritin sey make I tell dis pipol,
“Make yu nor forget wetin I won tok so!
Make yu koll di wimen and doz wey sabi kry
and sing beri song, kom.”
18 So I sey, “Yes! Make dem kwik kom
sing beri song for us,
so dat wi go kry and mourn well-well.
19 Make una hear Zion pipol dey kry:
‘Wi don die finish!
Dem don disgrace us well-well!
Wi must komot from awa land,
bikos awa house don skata.’ ”
20 I still sey, “Naw, wimen!
Make una listin and hear wetin God dey tok.
Make una tish una dotas and friends
how to kry and sing beri song.
21 Bikos deat don klimb pass awa windows.
E don enter awa house wey dem guide well.
E don kill awa shidren wey dey play for di street
and di yong men wey dey di town centre.”
22 Make una tell una dotas and neighbours wetin God tok:
“Dead body go full evriwhere like manure
wey dem skata for farm or korn wey dem gada for groun.”
23 God sey, “Make wise pipol nor dey boast,
bikos dem wise and make doz wey strong,
nor boast sey dem get pawa.
Make doz wey get money,
nor boast with di money wey dem get.
24 If anybody won boast,
make e boast sey e know and undastand mi,
bikos my love dey forever and I dey do wetin dey korrect and true.
I like pipol wey dey do dis kind tin.
Mi, wey bi God, don tok.”
25 God sey,
“Doz wey dem sekonsaiz,
but nor dey keep di kovenant wey make dem sekonsaiz dem,
time dey kom wen I go ponish dem.
26 I go ponish Egypt, Judah, Edom, Ammon, Moab
and di pipol for desert wey kut dia hair short for di temple.
Even for Israel, nobody wey dem sekonsaiz,
keep my kovenant for en heart.”